I just say make I enter facebook, na ein I come see one woman wey dey beg for money to buy Christmas cloth for her pikin.
In fact, that woman na small girl wey just marry come born pikin. When I see the picture, the suffering wey dey their side dey show well well. The house no get plaster, talk more of paint. Chai! People dey suffer o!
Well, the good news be say, people give her plenty money that day. I sure say the money wey dem give her that day go reach to start small business. But na only money to buy Christmas cloth for her pikin na eim she ask for.
God bless everyone wey give that poor woman money to make her baby smile.
God bless everyone out there wey dey put smile on other people's faces.
God bless the gentle soul wey dey read this post as him too dey put smile on my face.