One Instagram model wey go do butt implant dey cry for social media as the thing don dey give her serious gbege.
She be slay mama from New York wey go add something for her nyash make ein look big. But yawa con gasp as the thing come start to develop negative effects.
The slay mama con begin cry for social media and advice other ladies to love themselves make them no fall enter the kind wahala wey she see herself inside today.
My pipo make una carry her story learn wetin go help una.
I don write finish for now. I salute una.