RELATIONSHIP WAHALA

in esteem •  7 years ago 

FB_IMG_1532070005717.jpg
Source
My pipo my pipo!
TGIF! How una dey enjoy the weather? This one na for two. Na special weather for people wey don marry..

I just say make i check wetin dey happen for facebook, come jam this yarn wey i wan make we chook mouth put for the yarn.

Babe go e bobo house, e wan eat, come carry 4 eggs to fry wey only am go chop. E bobo come help am to reduce the egg, the babe vex come pour the egg inside sink. Na e the bobo vex join, give the babe hot slap. Na so the babe carry e bag commot for the house.

I still dey wonder why the babe go throway egg because say her bobo reduce am, i think say doctors dey say make we dey only chop one egg for a day, na e the babe go carry 4. E bobo come dey correct am, e throway the egg.
Wetin the guy do no good, e no suppose slap am, how much be 4 eggs? E for just leave the babe commot.

But as i just dey reason am, na so domestic violence dey take start. We dey only hear as the man take beat the woman but we no dey hear wetin make the man vex reach like that. Even if na just egg, tomorrow if e be something wey cost well well.

The only bad thing the bobo do na to slap am, but the babe no try at all.. Abi wetin una think? Wetin una think for the babe character? Wetin una think for the bobo reaction?


Footnote

**If you would like to support us,

Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.

We are naijapidgin community with a mission to *promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows*


Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

[Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Steemit Diary + Amebo with @rebeccafl [Fridays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapidgin Team:

The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...

@ogoowinner

@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|@akintunde

IMG_20180319_092844_398.jpg

Avatar designed by @mittymartz

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
Sort Order:  

@naijapidgin you were flagged by a worthless gang of trolls, so, I gave you an upvote to counteract it! Enjoy!!

Hmmn
Relationship for dis world sha

The babe no try oo. Even if she never eat for days, as she go person house, she suppose package nah. She just go there, go show the guy say she dey chow like mumu.

Maybe as the guy dey correct her, she dey run her mouth like mumu na him go make the guy slap her

Well, i have seen someone who eats four eggs. Thats because he is dieting and that four eggs may be what he will eat throughout the whole day.
For me, its abnormal but whatever reason she hers, if it were me, i will allow her eat the four. If i will reduce it , i will reduce it to two. Three and four, no difference.
No need to slap her.