HARDFORK 21 AKA NEW STEEM DAY- PIDGIN ENGLISH TRANSLATION

in hardfork •  5 years ago 

ymlx6gxmt2.jpg

Wen we hear the name hardfork, I know where una mind don run go and no be ferk wey hard too but na d very one wey go change everything for good. According to the oga dem wey dey in charge, dem yarn say e no go change tins immediately but slowly and jejely we move go d permanent site.

Wetin be d reason for this hardfork:
We don see and people don follow complain say steemit no be him again, say the pikin wey dem born 3 years ago don dey misbehave and because say him papa too give am free hand, e no get respect for humanity again so tey e come dey abuse the system. *"Papa no go fit leave him pikin make e spoil finish, he must correct am with right hand and draw am close with left. People don reap the reward pool sotey dem naked am. So oga @ned and Steem Inc team wan correct all d yamayama wey dey ground with this hardfork (upgrade) so that bidbot no go get level again
3bhnr0pu1c.png
Source
Wetin we dey expect after the Hardfork:
Na person wey dey chop, so if u be whale, Kpomo or Titus fish wey get steem power and u dey curate before and ur reward dey too small for ur hard work, everything go change kpatakpata. Every curator go dey get 50/50 with the author na. E mean say, if you upvote any person post and e upvote carry weight reach $10, u go get $5 for upvoting person and the person wey write too $5, kill am 50/50 no cheating. So people go dey put their effort now knowing say dem go gain las las. And people go abandon bidbot. And people wey dey write better article for steem blockchain, dem go start dey notice u know for ur hard work, dis one no be politics at all. And team of curators from different community go dey go round dey torchlight ur post if e make sense.
To get more insight for for oyibo, read am here from dis hanti @justineh [https://steemit.com/normietalk/@justineh/let-s-fork-hf21-what-to-expect] and from @steemitblog [https://steemit.com/hf21/@steemitblog/hardfork-21-survival-guide]

This one na before the Hardfork News, See you after the Hardfork

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!