.
So, on Wednesday, I had a first hand experience of secondary school cultism in the school where I teach.
It all started when I wan go piss for one korro, na im I kon see some guys wey dey ...
.
Wait.
.
Make I start from the beginning.
.
That very morning, after I don wait tire for nepa to bring light make I watch film and dey no com bring the light, na im I kon try read two tori from the 2014 Collection of American's Best Short Stories. But I no enjoy the tori because two things dey disturb my mind:
.
1: I dey think sey when me too go sabi write tori like the tori wey dey the book?
.
2: Na film gan gan dey my mind to watch.
.
So, I kon decide to comot for house to enter school. But first of all, I call my padis to make sure sey dem dey school. One dey. One no dey. So, I beg the one wey no dey school make e kon meet us for school because the guy get films for im lappy wella and me be dey wan collect more films for im hand tey tey.
.
So sha, in short, we three gather meet for school. As I dey collect the films for my flash, na im I sey make I run go piss.
.
As e remain small make I reach the korro wey I go piss, na im I see some of my students, SSS 3 guys, for one abandoned building. The students don comot their school uniform shirts.
.
Guy, when I near then the thing wey I see just make me laff. E remind of uni days wey guys be dey form cultists. But seriously, shey guys still dey do cultism these days? These days wey na money guys be dey look for.
.
Okay sha, make I continue the tori.
So, as I see the students without their shirts and with their bare chests wey dem don do X-marks for am and wey blood dey comot, na im I kon near dem well well.
.
(Some of them wan run but as dem see sey dem no get no where to run to, na im dem back down, dey hide)
.
Mehn, as I near dem well well, na im I kon see some more students inside another corner for the building. Some of the students hold blades wey dey stained with blood, while some other ones hold cultlass wey blood don stain am too. Some even hold some things like that wey I no see well well but wey I guess sey na their instruments wey dem dey use for their initiation.
.
As I see dem, I just smile for my mind because I dey pity dem sey these small small pikin don dey waste their lives away from small small.
.
'Wetin do you for chest wey blood dey comot like this?' I ask the students wey I see.
.
Na im the students sharp sharp run compose lie talk sey na fall dem fall. Their lie kon make me laff the more but I pretend sey I buy the lie, I tell them make dem sorry make them try take care of themselves.
.
So, I continue my waka. I go piss my piss.
.
After I piss finish, I go meet the students again go pretend sey I care. So, I tell them make dem follow me make we go meet principal so them go get adequate treatment.
.
Oh boy, I never talk finish before all of them say: 'NO NO NO. Nothing do dem, dem fine. Dem don use medicine. Dem fine well well.'
.
'Okay oo,' I tell dem. I kon leave dem dey continue my journey back to the office.