Why dead when you could avoid it

in lassa •  7 years ago 

REMEMBER LASSA FEVER

Aboki give me one sugarcane. You spray am betta water abi? ..... REMEMBER LASSA FEVER

Gimme 100 naira carrot there. You don wash am abi?... REMEMBER LASSA FEVER

Your garri dry well well? Make I taste am... REMEMBER LASSA FEVER

Bros! drink remain for me! Long time no see!... REMEMBER LASSA FEVER

Dọti no dey kill African man... REMEMBER LASSA FEVER

Oya O! We don know now say dọti dey kill.
If rat chop remain for you e dey kill. If rat shit or piss for your garri na lassa fever im dey dash you!

Cover your food O! If you no sabi how dem take fry de garri, no smoke am! No drink am! Use beta hot water cook am wella!

If you see watermelon wey dem cut, wey dey call you say make you buy... WAKA PASS

Pineapple nkọ? Abacha and coconut? WAKA PASS

Dat tin wey dey hungry you wey you no no how dem take cook am, weda na medicine wey dem soak inside ogogoro, weda na wetin you don dey dream of since... My brother, my sister, for now, I advise you WAKA PASS

Ring bell! 🛎Tell yasef! Tell others! Lassa fever no get medicine wey dey cure am.
Take time! Life na one coming!

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!