When country bad, wetin you suppose do?

in naijapidgin •  6 years ago 

Hello my people, I don land again with ogbonge tori wey go totori your belle. But today eh, na question I carry come una domot. The thing wey I want ask Una be say;

As we country bad so, e good make you run leave this country, abi e better make you stay back follow fight to make this country better again?

I just want know wetin dey your mind, because many of our youth, I don dey hear as dem dey make plenty plenty plans to leave this our great country run go another man's land.

This thing wey dem dey do, how you see am? E good as dem dey run? Abi e good make them stay back follow repair our country?

Una thank you o, as una go read come chuck mouth inside this tori.

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
Sort Order:  

@iamhumbled, go and place your daily vote for Steem on netcoins! http://contest.gonetcoins.com/