AS E DEY HOT

in naijapidgin •  7 years ago 

DQmUKSUbJf6GJypWe3AotmHNRN95riKkHAk52cqMRqfHJ2x.jpeg

My pipu My pipu
My belle dey jolly as i dey salute una this beta morning as we sabi say na weekend we don enter so and i sure say we dey flex am.

Today tori na ogbonge one as i go like yarn am as e dey hot.
I sabi say una get correct ideas wey dey una belle and you go think say how i go take carry this one comot. I just wan sama una small things wey una fit do.

  1. Believe on top your idea
    The truth na say nobody fit believe on your matter pass you. And you go surely get people wey go talk say wetin you get no make sense but na you go come reason dem say you sabi wetin you get and na correct.

  2. Get beta sense for the matter
    If you wan do something e dey betta make you get correct sense inside the matter so that you go fit succeed. Oyinbo dey call am understanding another thing wey you fit use get this sense na wetin oyinbo dey call Research. This one talk say you go find plenty things wey dey about this thing wey you dey talk

  3. Oya action
    Many pipo idea don die or e don cold becos dem no do anything as e dey hot. Our people say, "na when iron dey hot dem dey knack am". If you wait sotey ginger no come dey again to do wetin you get for mind, the thing fit kpeme. So i go like say make una do action as e dey hot.

This na my own simple ones, abeg una fit add the ones wey dey una mind.
Na your boy @preciousimo bring this one today oo.

Na we be naija pidgin
Na Spirit of Naija!!
Na we be Naija!!!


Footnote

If you would like to support us,
Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.

We are naijapidgin community with a mission to promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows


Join our discord server for fun, interactions and voice shows here

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

  • Real-Life Talk with @preciousimo
    [Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapidgin Team:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain:
@ogoowinner
@zizymena
@oliverwilliams
@horlaide
@mittymartz
@nmalove
@preciousimo
@rosyblessing


Na @mittymartz design this avatar

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
Sort Order:  

Nice post mn..
I am new joined this platform please follow m and support.

Na correct yarn you yarn so @naijapidgin, the main koko for the matter be say, make person always dey try push him goals and aspirations for every step of the way. Like you don talk am reach ground finish; nobody go fit die untop your matter pass you.

Weldone guys!

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

This own good gan. Nice post @presciousimo