BABA BUHARI DON COME WITH NEXT LEVEL

in naijapidgin •  7 years ago 

Naijapidgin Admin 20180226_141406.jpg

My country I trowey ogbonge salute for unah o.
How unah dey?
How unah take dey hold body for this we change?

My people as we promise unah to dey bring unah latest latest gist come unah domot….. especially the one wey concern us and the one wey the happen for we country so we the @naijapidgin community don reason this tori carry land unah domot make we chook mouth put base on how the matter dey hot.

This matter concern me and you because any decision way we make now we go either suffer am or enjoy am for the next years wey the come.

Nah so I wake up one morning say make I carry my phone do my normal thing wey I dey do make I first check my sbd wey I make, check my whatsapp messages, then do Facebook small nah so I just dey receive news and pop up message everywhere even for TV say our number one person for we country wey dey handle every matter, the person wey them dey call GCFR. don come outside declare say him want run for second tenure and wetin this one mean be say if him win for the next 4 years nah him go still dey in charge of matter for we country Hmmm…..

Nah true say for every country, the country people dey always choose people wey go run their matta base on the party system wey dem agree to the use and for we country naija our own party system wey we dey run nah democracy wey nah we go choose who go run our matter and the person go stay for 4 years first tenure after when em go run again and if him win him go come run our matta for another 4 years..

download (2).jpeg
Source

And our number one person wey dey run our matta for the country don come outside tells us say him don ready and him want comot for the second time.

After him don the finish him first tenure we been don the wait and expert weather him go comot again or him no go comot and finally him come talk am.

I remember the first time wey BABA want comot under APC him promise us plenty things we him go do the slogan wey dem carry come that time nah CHANGE, all of us been happy base on say we don see person wey go change our country.
Nah so we come vote am give am power him come the do things slow slow sotey them begin call am BABA go slow.

Now him don talk say em want run again and this time the slogan nah NEXT LEVEL….

The funny tori now be say since baba talk say him want run again nah so so people just the react anyhow, for social media, for tv even for street self.
Nah so I hear say immediately him declare nah so our stock market crash we come loss 50 milion abi nah billion self, e no finish o one of my guy talk em own say nah as buhari declare nah him we come get national rain which means say nah heaven the cry because baba want come again….
Some people say this buhari time nah so so suffer people the suffer now him want come back again……hmmmmm

MY COUNTRY PEOPLE NAH WATIN WE GO DO FOR THIS MATTER?

UNAH THINK SAY THIS NEXT LEVEL WEY EM DEY PROMISE US SO NAH THE WAY FORWARD?

UNAH THINK SAY EM GO FIT WIN AGAIN?
WETIN UNAH THINK SAY WE YOUTH FIT DO TO HELP THIS MATTER

no forget to the show us love with unah upvote, comment and resteem.

and if you want join our what'sapp page were e dey happen make you click here

nah @oliverwilliams bring this gist for us

nah @mittymartz give us this fine avarta

IMG_20180215_155325_695.jpg

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
Sort Order:  

Say BABA

SAY BUHARI

Hmmm

Na that hmm kill you Dia.....

Loading...

I salute una o
this man Don too old nah
This e stage na to Take beta seat take sit down for e parlour the eat e money till next 4 years wey e fit die ( no b say I d wish am to die o).
this next level wey e wan carry naija people go, Na next level of suffering, difficulty, killi killi and kwuruption.

people say the man no good, Na the same people still wan vote am in again.
Why we youth no fit just call spade a spade. Nigeria Na d only country wey money the buy the cover everything wey bad even for our koro Koro eyes.

I just d wish say all the youth for we country fit get one mind vote d man out.

My brother no be small thing o.
This our naija enh nothing man no go see

Yesterday when them raise this matter for my office, one man talk say e better make we allow am go the second term know say hausa tenure don end and make presidency shift go meet the Yoruba people. Him argument na say if we no allow am another hausa man go enter and he go still want go two times. The matter just tire me. We know say election no be free and fair for we country. No matter wetin we do them go still rig the election.

Since them born me I never see where power tire this hausa people Dem just believe say this naija nah them father property anybody fit come rule.
Even if you give them chance tomorrow Dem go still come.
But me I know say if we ready we go comot am the way we take comot goodluck jonathan.
GOD go help us

Me no get wahala for them matters o. If i fit make my moni on my own how their election matter take concern me.

My brother the problem be say even if the matter no concern us you know say some how the matter go affect us or the people wey we love

I trowe salute for una back!

For me o, anyone wen sit down for the seat nai baba God don appoint for us, i go support that person.

@naijapidgin, una try for this news

Come... better go find pvc oo make una vote well

Hmmm you don talk well but him them still talk say heaven they help people wey help their self o

Y u d yan like this nah
u mean say Na Baba Goddey
appoint Buhari make e cum d suffer us?
I no fit support bad tin.
something no fit enter my eyes two times
you still expect me to open my eyes for the third time.
I greet u... Ma

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

For me i must vote bck our baba go slow oo,, all of us must finish this thing wey those people way first vote am in start.

Hmmm this one you sure say no be purnishment be that.
Tornah all of us go suffer am Sha

If all of us come out massively come do watin we sorpose do I die if him win again

Chai, Buhari get mind!
Abeg those animals wey swallow money, make them follow swallow Buhari biko
We no go gree o, we no go gree!

Our country too dey corrupt, they know the next GCFR, so voting na just waste of time and to make am official. Wetin concern me?

My own na to make money
One gbosa to @oliverwilliams
Tuale to @naijapidgin

The man dey smoke.

He one carry Nigeria enter he grave? Nigeria na he personal property?
Make them nor let me Vex ooo..

Naso I hear for radio when one stupid man dey talk say Nigeria youth when be politician when dey the age range of 50's nor VA get the capacity to rule the country. Which kind nonsense be that na

As for me on this matter buhari better go treat himself instead of am to they yan rubbish ooo 😡 😡

Buhari don come again o next level of suffer abi wetin God no go kuku let am come again fir second term the suffer don too much people jus dey like fowl everyday becos dem no dey feed well as e be so na God go fit deliver us from all this mago mago politicians none of them good
See jobless youths everywhere if person no go school now na wahala person go school gradute no work so so lie lie we don tire abeg

Say baba
U be leader