Breeze Don Blow Fowl Nyash for we Government

in naijapidgin •  7 years ago 

Naijapidgin Admin 20180226_141406.jpg

My contri people I trowey ogbonge salute for unah o!
How unah dey?
How unah take dey hold body for this we change we dey touch every body so?

Today we don come again with another matter wey we want make unah for chook mouth put.
This matter don tey small but I still want make we reason because the matter just the surprise me how federal government take the play us like 10 10 for this we country

When APC been want enter government come run our country matter nah so them promise us heaven and Earth sotey....... baba promise is say one of the matter wey him go carry serious with red eye nah the matter of people wey carry our country money run chop am with them family wetin oyinbo dey call corruption.

Nah so naija carry power give them we no come hear anything our naija information minister go come outside talk this one, federal government go come outside talk another one sotey dey matter tire me

Nah em recently federal government come put one list for online say nah the names of people wey chop our county money make we read am even as them know say we no go fit do anything nah just to read we go read am.

Wetin the shock me be say nah only naija person go steal 1billion with pen and paper Dem go catch am em go come use 10million bail himself.

Abeg country people unah think am say nah the right thing them do?.
Abi unah think say this name wey them release fit help us fight this corruption?

Abeg make we yarn like one naija wey we be

make we no forget to the support our own naijapidgin so the we go fit the grow.

make we no forget to the support @naijapidgin with our upvote, comment and resteem.

nah @oliverwilliams bring this one for us.

you fit join our WhatsApp group where e dey happen here

nah @martymitz give us the fine avarta

IMG_20180215_155325_695.jpg

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
Sort Order:  

Nor vex ooo @naijapidgin but baba na fuck up guy
na bias person so i nor like talk for he funny behaviour. the only thing when i get to talk be say make our youth get up for this change to happen. Make we come out to participate for politics
only with that naija go take better.

My brother you don yarn well

This one na serious stori, This Government don spoil na only God fit help us build am again. Den dey show us names wey we no fit do anything. This country na yeye country.

@parrotmouth nor forget say the country so nor be the lland ooo na me and you you na be the country so o

This matter tire me o. E mean say I fit go steal as government official, come pay 1% a bail. AAs for me my advice for youths and our country people na to go get their PVC make them vote for their right person... Long live naija pidgin....long live nigeria..

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

goodday everybody ooo na me your guy @dante1 see ehn dis our country matter don tire me dem just think sey all of us be goat just dey yan us shit can you imagine make person loot 1 billion come dey use 10 million bail inself which kind nonsense be dat i swear down we suppose dey di wetin dem dey do for chaina make all of us just stone all dose politicians wherever we see them make dem sabi sey we no like dis stuff wey dem dey do cos if we no act them go continue with all this shit and seriously d tin dey pain me but na here we dey dem just make we youth useless for dis country

@naijapidgin
Una dey try for all dis news wey una dey carry come our domot
This ya community too much
👨‍✈👩‍

Just like that woman bin talk for comedy say this our nigeria no go beta again. Me sef, I dey follow leave this naija go my village cos I don give up hope for this country tey tey.😂😂
Anyways, we no fit do anything on weda govt. Comot list of fraudsters or not. Wetin dem Comot Dis list make we do now? Go flog them? Na dem get d power, make dem punish this lawbreakers and stop making it possible for Dis people to come bail demselves again using money. dat Way, wen them experience real life for naija prison at least e go teh b4 person think twice about stealing money for this country. But last last, d person wey dey follow release list dey steal his own silently so him no go wan further d case that justice be carried out so dat wen him own time reach, him go follow escape 😂😂
So for this reason, I think, I know and can prove further say the only think this country need be prayers ooooo just like John Billion bin sing
"my mama said ur whole life is in the hands of God"...
Only God fit help us. Lol.
Very soon now, this youths wey dey shout go go vote again for baba😂😂😂

Naija i hail ooo... Una too much joor