My Naija people how una dey, I trowey salute give una oooo.
And I welcome all of una to our ogbonge naijapidgin blog.
Today na Tuesday so make una use am make up for work wae una no finish yesterday Monday
Wetin dey happen? Relationship nowadays don be like football wey dey get many players. Everywhere you turn na he cheat on me or she cheat on me.
Na so kasala burst for my area yesterday when one guy catch another man ontop him woman. Na so fight scatter everywhere.
So today I want make we yarn this matter.
Dem don cheat on you before?
Wetin you do when you find out?
Wetin be the best revenge to give your partner wey cheat on you?
Abeg make una shook mouth for this matter as e dey hot. We go like hear wetin una opinion be.
Today na @rejoiceavl birthday make una help me wish her happy birthday too
Make una come join us for our Whatsapp group by 9pm
If u neba join click here
Na @mittymartz create dis post for naijapidgin
Avatar designed by @mittymartz
No time to dey reason the matter my people the babe wey cheat don ready to go ni... make she dey go. Make person vex no help the situation. If person go vex, wey person no go get self control come go do something foolish, na to say person don scatter person life be that oo.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Dem never cheat on me b4. But as per revenge or wetin the other partner go fit do about am, if na me, na to free the girl oh. Life no hard. Person wey dy cheat no worth to fight about
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
True talk
No point at all.... So long the person fit cheat
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Wait o make i read wetin you write well.... U say!!....me romeo fight for woman say who die na? You no dey see my name...romeo
Broda see make i nyarn you eh... na only man wey no fine or wey no get money dey think for that level u dey hear me
As far as say pepper dey your pocket wella and you come fine, omo leave am...na babies go dey follow you like flies dey fight upandan for you.
I don nyarn you finish o!
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Baba I feel you jare, i fight on top one mumu girl becos say girls don finish? Tah.... Make she go baf
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Lolz...i don die! Wait o, you say make she go baf, she no baf before? Come dey follow fine boy.
Baba forget steemit matter eh, if my man dey my front fight for girl eh, kai, ah swear i go disman him
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
I de feel you jawe
But ur name de different from watin u type
Romeo wae I know die for love 😎🤣😂
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Hahahaha.... Broda everything don go digitalised now, shebi u know?
Romeo that year na analogue but we dey digital now so no one dey die for love now for baba Jesus don tidy that one tee tee come say, "e don finish"
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
my brother for yonda relationship for naija get as e bi oooh... na now i de see the reason why one Nigerian singer say if you no get money you be monkey..... make i no two talk but e bi like say our own for here na hi worst pass.. imagine say for your korokoro eye one man go come carry your woman waka... she go come back buy you sharwama ...
meself tire for relationship for wee country.
anyway make una de try follow me and helep upvote my post my i for get yafuyafu bandwith to talk wella with una
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Na true xha
To find better babe wae no go cheat hard
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Hmm, this matter na serious matter o..... But to talk true, if u nor get money, babes nor go reason ur matter o. Who wan suffer?
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
True talk
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
I greet all of una one by one
Na better Tori b Dis.
Some girls no dey try at all.
some niggers no dey try join.
my case Na strong one but e don pass.
my guy just show back from London come pay me visit. As e dey hot the guy see one girl for my room, ask me who the girl be. I tell am say Na my girl friend.
My pipu the Tori long make I cut am short.
this two people cum dey do show for my back.
As I find out.... Some girls no go like wetin I do.
but make I Sharam. All her female friends wey b dey cut me eye even as them no say I be their friend boyfriend....
them give sound track finish in a way she go find out.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
For me sha, i feel say the best revenge na to make the babe be like mumu. How you go fight on top babe way cheat on you, you don too fall your hand be dat na.
For me, i go begin laugh the girl, make am be like say e no pain me. Make she begin doubt whether i bin like her in d 1st place. Because if you let am be like say e pain you, then you don become the victim. After I laugh her finish, i fit be like "finally... before i come back, just do d needful", then i laugh comot like say e no pain me, con carry myself go one corner begin console myself 😂😂.
But i swear, any guy way fight becos of im cheating bae, don fall hand full time
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
My broda your brain get excess oil o. One thing wey we guys no know be say, once a girl don sabi say wetin she dey do dey pepper you for body, your own don finish be that o!
She go jee jee dey do that thing make e dey pepper you more. Na so their fish brain be o
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit