HOUSEMAID PALAVA

in naijapidgin •  6 years ago 

oaEY5Y9.jpg
Naija una well done o
Naija pidgin don carry another ogbonge tori come again!

Walahi people wicked sha.
E get tori wey dey trend for my area
One man and e wife commot for house, leave their pikin wey never reach one year with their housemaid for house
As they come back, open door, they see say their pikin hang for fan wey dey blow
dey come off the fan, bring down the pikin but the pikin don die and the house maid don run.

I come dey wonder,
wetin go make the housemaid get that kind mind hang pikin for fan?
If it be say the madam dey wicked am
but even if na so
The maid suppose kill the pikin?
Naijapidgin how una reason this matter?

If na you wey this kind thing do,
you commot, your maid kill your pikin
wetin you go do?

Make una help me reason this matter, because i no fit shout!
I wan hear una tori today..

MAKE UNA NO FORGET TO UPVOTE, COMMENT AND RESTEEM, SO THAT YOUR PEOPLE GO FOLLOW CHOOK MOUTH FOR THIS MATTER

Na @nmalove bring this tori come today.

DQmQkNYBpYh7mPEJV6KFqxCfneCsy8kYxgzH7Lg91z6zf7o.jpg
Ma @mittymartz design this ogbonge avatar

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
Sort Order:  

Watin i dey use house girl or house help do for my house?.
God no go allow that kind thing happen to me sef because i no well for where house help dey.

Lol wen ur money long lik toilet roll, and u come get big big manshions lik mount everest u go need d maids oo

Amen, e no go happen.

Well, this tori na serious one oh. I mean e tie wrapper well well. As I reason am, e fit be say the oga Don dey treat the maid bad before na I'm make her fit do that kind thing. Bur that kind thing bad wella. E no get as dem treat you back reach wey go make you kill innocent pikin. Well, if na me be the parent, na to put everything for God hand, you wey kill person today go still die someday. "he who kill by the sword shall also die by the sword" but meanwhile, I go report the issue give police 🚨 make dem find the killer and bring her to face the law. Na so I reason am my people.
@sleempeterz

Yes o, na pure wickedness be dis, even if dem dey treat the maid bad, e no suppose do dat kind thing..

Before that kind thing go happen, e go be say the oga and madam dey maltreat the girl or devil dey use the girl play Mario. When I small, my malle don tell me say one maid wey we get wan try kill me. Dem find out say na her village people dey do am when dey carry her enter church.
If na me e happen to, I go Waka go the girl village arrest everybody for her family. If I can see am I go kill am too.

No be small mario.. Nawao, thank God say the maid no succeed for you o. Na God go save us from this people.

Hmmm this one badt sha, i believe say the maid fit be witch oo because to kill small pikin no be somthing wey dey ordinary,
People wicked sha even if dem treat her badt ehh e no stil reach for her to kill person baby oo, well for me na 2go her village arrest every body for her house, declare her wanted, come put money ransom on top any her head...,
She no fit run go anywere o.

Thank u jare, ee no get as u maltreat her reach, dat pikin no know anytin about am

Mehn this story big pass my entire voice...
That kind thing...
Why people dey wicked like this seff?
That one na witch them go carry so... Person suppose dey go strong church... Carry ur house help show ur pastor kpatkpata... Hmmm. Man fear man ooo

Dis matter na one bitter truth wey dey happen for some houses for naija o. Person go employ housemaid to help am do work for house, the maid go come turn into moster for the house.

Wetin dey even cause things like this? Surely na the maltreatment by the oga and madam towards the maid. Most times, maids dey really suffer well well. Dem go do all the work for house, food them no go chop and for every little mistake, na serious beating.

All these go come make the maid to develop serious hatred for the oga and madam to the extent wey dem fit do anything to harm them and only way for this revenge na thier children.

But no matter how the wickedness be, wetin this maid do no good at all. E dey very wicked of the maid to kill the innocent pikin for wetin the pikin no even sabi.

If i be parent of the pikin, i go quickky report the matter to police and wen dem catch the maid, he/she go face the full wrath of the law.

The maid for commot for the house if them dey maltreat am.. Why e kill the pikin? Na pure wickedness

Na wa oo, d matter heavy for ear no be small, na y ppl gat to dey careful, no be everybody wey dey waka be human being. A baby not upto 1 year wetin the pikin wan do anybody? My country people make we dey careful the kind of persons we invite to our houses oo especially those taking care of ur pikin. This matter pain me shaa

No be lie! No be everybody be human being.

I no even know where I want begin dey reason this matter. Na wa! This housemaid get mid o. I no imagine an sef . Na allthese things make me talk say i no go get housemaid