How we Youth fit take Help our self for this our Country

in naijapidgin •  7 years ago 

DQmQ2FzwofMUx4b5SLxs6d55uQgurie5pT6BckkwmvPkFQL.jpg

My country people I great unah o,
how go d go?
How unah take dey hold body for this our change?

I sure say unah enjoy our last tori wey we don dey hammer unah since, but e be like say we don too the play games this two days.

So today make we talk about wetin concern us we youth for this our naija.
The ogbonge talk for today be say “how we youth fit take help our self for this our country”
But before I yarn unah the tori make I first catch brake congratulate the people wey win our package yesterday for we telegram page, their names nah
@princeene001, @matadoni, @rebeccefl

No be lie say job no dey we country, everyday nah so so hunger, food no dey to chop, everywhere dry,
even me self wey d talk so never chop since morning.

And nah so every year nah him our schools dem for naija and even the one wey dey for obodo oyinbo the produce thousands of graduate enter we labour market and enof work no dey wey we country fit carry all those people.

Abi make we stop to the go school neh? Since if we go schools we no go get wetin to do?

Country hard sotey people wey comot from school no see work, people wey come get the work before nah so dem come d sack them,
Nah em we come the gather for ourself head like geisha.
The matter tire me wahali

Before before when our papa dem been go standard six and seven when oyinbo people dey we country, before dem finish school everything go ready dey wait for dem.
House, car and even work go dey on standby,
but now everything don change.

The matter wey come they pain me pass be say this our yeye politicians wey there children no school for naija before them even finish schools their job don ready for them.
We wey no come get mouth how we want come take help ourselves for this we country
Nah so APC come promise use change and the change come make everybody the cry so.

Wetin we go do?.
Them say heaven nah him dey help those weh help them self.
How unah thinks say we fit help our self for this matter?
Abeg make you yarn your own opinion for this matter.?

And if you want follow win our package every day then make you run sharp sharp join us for telegram with this link here

If you dey enjoy our tori make you no forget to upvote, resteem and comment for this post make we community dey fit dey grow

nah @oliverwilliams bring us this tori today

@mittymartz help us arrange this beautiful avarta

DQmQkNYBpYh7mPEJV6KFqxCfneCsy8kYxgzH7Lg91z6zf7o.jpg

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
Sort Order:  

Omo e no easy for ezekiel inside this kin naija wai we dai soo, as e don dai hot already men don dai change levels of hustle for area lik dix oo.. N since we na original black peopl sha, atall atall no b winch we go stil survive.

E get plenty plenty thing wey youth fit do for thier self for we country Nigeria but i go talk only two.
1.make dem no dey expect govament to dey do everything for them but make dem dey think of wetin dey fit do for we country Nigeria.You fit create work for themself without waiting for person to give them food.make dem dey think of ideas wey go help beta their lives.
Ok see as wey dey steem.Na beta thing.Steemit don dey make we wey be youth to dey put mind for beta things wey go write and e dey help us.

2.Another thing wey we youth fit do for we country,na for we youth to comot hand kpata kpata for bad bad things them.make we say no to kidnapping,rape rape, thiff thiff,killing killing and sex wey no clean for God eye.if we dey do all things dem,we country go beta.Abeg make we use we life and time take do beta things for we country Nigeria

My pipple this one na ma own oo.

This we country tire me no be small . Person wey dey wait for gomenti dey waste im time. Job no dey as you talk am say thousands dey graduate every year na so e be.best thing na to go learn handiwork. no shame say you be graduate. Person wey dey shame no dey chop party rice. Na your future you dey build so. Work hard. Learn hardiwork. Find money start business. If gomenti work come you take am hold body of no come nothing spoil. @naijapidgin una do well o.

Na to get handiwork oh...may we no dey wait for government to give us white collar jobs. If I get my own business, I fit employ 10 people, train them, when dem comot for my side start their own, may dem employ 10 too...poverty and fradulence go reduce for our country.

my sister thank you say you chook mouth for this our matta wey we dey yarn so.
the truth be say this our government don fail us for this we country if all of u go fit go learn better handiwork do nah him be say e go help us wella

First of all i wan say naija pidgin una thank you for yesterday gift o...
Concerning the matter wey de ground, this one no be today matter o, the problem dng de since the beginning of our so call independence. And if you ask me na who i go ask. Well the truth be say we as youth eh... We gat rise up, no be all about to find hand work, hand work good but if we get hand work and we no get enabling environment to help our hand work produce money boku boku, de handwork de meaningless. We gat rise, make a move and show this people say this resources na for all of us no be for them and their family. And hw we go rise up? No be by to carry gun o, God forbid! Na to chuk mouth for politics and the election process, to vote for the right people no be for people wey give you 5k and small rice during campaign after that you no see them again when them win. Na to vote for good eligible people. From there beta tin go come inside our nation and tinz go beta small small.

My pipu for we great country I trowey salute give una. Before I chuk mouth put for this Mata.
Make I recognise person wey make dis house come dey today,@ogoowinner.
This country Don tire plenty pipu, no b today the tiredness start o.
we dey used to the country, so as the country no give us hope again,we suppose wake up from our sleep find our own means of survival.
Most of us Na graduate, as the paper we get from the school never the help us as our government Don sour. We suppose find HAND WORK do on.
this days nothing the pay like wetin you sabi do well.
as our government Don fail us, our hand work no go fit fail us because our papa God sign am say HIM go bless our hand work. Since I sabi God, E never fail me.

Another thing wey I get to talk about this issue Na to make sure say we fit find out our raw talent, all of us get wetin baba God put inside us before we come land for this part of the world.
if we fit find our talent quick quick before e late, we no go de depend on our government wey Don sour for employment.
@oliverwilliams I greet you specially.

well for me eh, as you dong talk am before say: _heaven dey help those who help themself', my advice be say:

  • make everybody especially our youth dey choock eye for crytocurrency business and other beta beta businesses wey dey online, bcos money dey dey well well.

  • also make our piple(youth) at least get beta beta handwork wey feet bring money enta dem poket evriday.

na wetin me think sey we feet do make we help our self be that o.

The mata self tire me but the tin know tire my God. My own be say make we youth forget about all this yeye government dem,nothing they get to offer us than the frustration and surprise wey den dey give us. Apc change, snake swallowing moni, starvation all na for dis our naija. This time make youth go school but find another way to survive like to learn trade, or learn handwork. If job opportunity show try ur luck. But if we too reach power after all this our bad politicians dem done go, make we wey go rule den know make dis earth a gloomy doom for the next generations

As confirm naija youth. I go advice make every youth make effort to acquire one skill or the other. This nation the only thing we fit give us small money for the main time till we blow.

Make I use my matter do example, since I graduate for 2016. Na graphics work I dey use hold body. The money wey I dey make no plenty but at least I dey use am hold body.

Sometimes sef big jobs Dey come and I dey make big money.

The point be say make we get something wet dey bring regular income. The truth be say no be everybody go get white collar job.

Naija youths get lots of creative skills, make we lit am to use Abeg.

Dulling Na sin

Dat ting we you yarn so na im oga patapata dey call status quo. We no go talk am only for mouth, time don mature make we all enter jungle. Make man pikin no dey sell dem vote unto say dem dash am shinkili money. Me happy unto say de future wey I dey see so go be one wey dem go decentralise; one wey no go get oga wey dey top dey chop only am. Make we kukuma begin dem revolution wey no kari wahala.