My country people,
Well-done o.. How una dey hold body for this naija? Hope say una don dey ready una PVC for net year? No dulling at all
Today na another Friday, naijapidgin don carry ogbonge tori come again.
source
Una know say plenty things don dey happen for those people wey just commot from big brother. Many of them don dey get job up and down. The one wey shock me be say, IMO State Governor, Rochas Okorocha don make Miracle, the guy wey win the show Education Ambassador for Imo State. I happy for am because me self like the guy, but wetin I no understand be say, how big brother show take concern education? How e fit represent Education? E get wetin dem dey call Scholars for that State but the Governor no dey even look their side.. How Miracle win take help Nigeria and Imo State?
E get other government work wey fit big brother, e.g Culture and Tourism. At least dey for make am Ambassador for Culture and Tourism, e for make sense pass. Na this kind thing dey spoil our countri, to dey put people where dey no suppose be, abi naijapidgin wetin una think?
Make Una help me reason this matter.. Una think say IMO State governor do better thing? Una think say Education Ambassador go fit Miracle pass Culture and Tourism Ambassador? Make una chook mouth for this matter because me sef dey confuse.
If you no dey our whatsapp group, come join here
Na @nmalove carry this matter come
Na @mitymartz design this avatar
Na d ogbonge problem wey naija dey face b dis, why nah. BBN no even concern educational stuff, even the program is not educating.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Una good morning ooo..Na beta gist be dis sha. I been read this thing online some days ago and i was like 'our naija pipo don do am again'. This na one example were show that most of our state n federal reps like this Imo state Governor no dey give offices to d right person. I no mean say miracle no sabi book oo or no go sch(ofcourse d truth is vice-versa) bt dat one no mean anything. This bbnaija somefin na unto entertainment stuff so i no see why he come concerned govt to give him Ambassodor for Education na... Aba. Wetin bbnaija don impact for educational sector sef? No be to make most of our youths lazy and carry housemates mata for their head? Lol..Wat happened to giving miracle money, or ambassodor for culture and tourism like una sey?... And then giving tht position to a more suited personality? Nothing for dis country dey surprise me anymore. Offices are given based on connection and influence and unto sey miracle bin don make him govt. proud, him na influencer now so... Nothing we fit do
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
The thing tire me, i swear.. Na wetin dey spoil our countri be this.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Yes
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Me no fit blame Rochas for this action when even our presi dey make senseless appointments. When him use Dalong who no sabi anything do minister of sports when the man no get any idea.
This nation need prayers Abeg. We need to they reason properly before we do things. We no suppose they do things because we fit do am and get the power to do am. Which qualification Miracle get for them to give am that appointment? Even if them must give am appointment why e be say na for sector wey dey as vital as education. We all know sey his country get epileptic education yet we carry celebrity put for there...
As for me e no make any sense
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
No mind am.. Wetin dey wan teach younger generation..
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Niger I hail oo, for this country doctor fit be ambassador for tourism
Na how corruption don chop them finish, no be me oo
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Haahaa na waitn we no go hear or see slf for dix naija, for him mind BBN na educational show..
Make dem continue oo, all this useless things go soon end.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Una tink say una don see smtin for dis country. Shebi my governor dash last year winner Efe two cars with 2million and the best graduating student for d state university receive handshake.
Okorocha don dey do wonders since, Shebi na him gv him sister Commission of Owambe. Dis one no be strange tin at all.
Make miracle take IMO people how to dey straff for national t.v. cos Rocha no know d meaning of Ambassador. Make him gv Buhari-Ambassador of Travel Travel
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Na so our country be oh... Every thing b like joke.
Bkuz till today, I never sabi wetin BBN dey promote
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
did mater tire mi.
miracle no fit for that position atall.
Na God go help us with the way were we dey do things for this naija
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
No wori ino go tee, he go appoint naijapidgin as ambassador of news and languages
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Lol. That one beta na... Afterall na news we dey receive from dis blog @naijapidgin
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
This Imo state governor like to trend... Although Miracle na smart person for BBN House but, nothing concern am with education at all at all.... This governor just wan show himself!
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit