My country people I trowey ogbonge salute for unah
How unah dey?
How unah take the hold body for this we change wey d touch everybody so?
Make unah no worry I know after every every better go show
So today I want welcome unah to our ogboge naijapidgin blog and as unah know today nah another beautiful Sunday and we Don arrange another better package for ourselves.
But before I yarn unah the Koko
Make I first use this time thank all of una wey don dey support us since the day wey we start, if no be because of unah we for no dey where we dey so, if I look back see d things wey we Don achieve together the followers, the upvotes and the WhatsApp activities nah so so joy full our heart
Abeg unah too much
We say thank you
So today we want do small thing we them dey call "send us your message" and nah for weather you b christain or you b Muslim
Wetin e mean b say
You go go the comment section, upload your fine today outfit as pishure
Then write your short best motivational message and send shout-out to anybody wey you want send
Make e no pass 100 words
The person wey quote and motivation make sense pass go win price
Note: the admins get right to change the rule of today and d price anytime
for example
My country people I great unah my motivational quote for unah today b say no allow anybody make you look less of yourself make nah you go decide you own happiness
I want send shout-out to all the admins of @naijapidgin.
My contiri pepul, my hand dea up as i dea hail una, shey make i bring my yand come down???
As we wake up see today lasan omo na Godiwin o, sey awa market for @naijapidgin sell omo na godiwin
My own ogbonge memorandom, stimulus and motivation for today resemble poem but na ogbonge message for people wey get ear
Abeg, make u try Always be yourself,
Trust for your efficiency.
Make you Walk your way to the top,
And stay strong.
Express yourself,
Have faith in yourself,
Don't duplicate your self,
Build your personality, other than looking for a successful personality to duplicate.
Enlighten yourself,
And above all patapata be say Trust God
@diamondrich, I twale... I see you
@zizymena, I'm with you spiritually
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
My people my people na me be that una fashionista @mritsnobigdeal,
As today be sunday and as e de hot,you see this life?na only you fit motivate yourself, no allow person make you feel say you no follow.
As you de like this, you better pass plenty people and plenty people better pass you but wetin happen be say, de your lane and make other people de their own.
I wan tell una make una de fearless and make una continue de shoot una shot, e go everly better one day.
Make una flex una sunday de go.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
My contry pepo i greet una ooo say make una happy sunday oooo my motivational quote for una today be say anywere you carry yoursef put ino matter the kine weather wey dey or circumstance jus make sure you bring your sunshine, do wetin go make your soul shine cause there is always something new wey you go learn each Sunday... Stay strong ma pepo @naijapidgin
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
My country people I greet Unah say make unah happy Sunday o. My motivational quote for Unah today be say make Unah no fight the pig because Unah go end up staining unaself and the pig go enjoy the fight wella. I Wan trowey my shout out give all them @Naijapidgin admins.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Adekunle ajasin university right?
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Yeah bro
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
There's something my p man They always yarn. Him they talk say
"It is foolishness to be shameful of what is gainful "
I wan air my shout out to all Niger youths wey they hustle for street
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
My country people I greet una o I wish everybody happy last Sunday of the month we go live to experience more in Jesus name my motivational quote for today be say make we dey learn to respect our elders so that our younger ones go respect us too.
My shout out na for all naijapidgin members and steemians una worldwide
Na your favorite babe @rosyblessing talk am 👑
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
I sight you in 3D.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Lol
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
My country people I dey use my church mind throw away unah salute.How unah dey?
If this wild wind of change never blow reach your side no forget say
"Akara and moin moin get the same parent na wetin dem pass tru make dem diffrent".
As you dey waka enter this tear rubber week.. I wan make you carry this wan for mind:
"If life dey show you pepper my guy make pepper soup"
Make unah Enjoy.
@oliverwilliams and all the @naijapidgin team, .. Thank you for this opportunity wey unah don create. I dey feel unah die.
@martymittz ..For that fine Avatar where you give us. You too much. You deserve some accolades.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
My country people I lie down gidigba for una, my motivational quote for today be say happiness no be something wey you go postpone for the future, na something wey you go design for we present... Because na during our darkness moment na e we go see the link.. So make we no give up, make we just get hope say e go better.
And I go like give shout out to @zizymena even though say she no like me 😔😔
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
My people My people una good afternoon to una oo, and happy Sunday too join.
My motivational quote for today na,
Most of us because of our background we done lose hope say we fit make am for this life. We forget say baba God wat make us, do us all to become great for this life.
The only thing na for us to fin our purpose for this life and put am into action, not minding say we come from poor background or house. And as we dey do so God go con see us through, from dey we fit make am.
I wan send shout outs to @zizymena, if no be for her, I no go put eye for @naijapidgin. Na she make me know say this place na better place to be.
Thanks.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
I greet una well well my people especially @naijapidgin wey take in own good time organize this ogbonge show. Shout out to you @naijapidgin u Don try wella and I believe say every thing wey u dey find, u go dey get all of them one by follow.
Wetin I want yarn for my quote be say;
The sheep talk say e no sabbi dance for music for any where wey party dey ground but the day wey the music go set for e compound Wetin e go do atleast be say e go start by jumping. Wetin this one mean be say anybody wey no the find person trouble and one day another person come go look for e trouble, the person go find way treat the matter wey dey ground.
The only banga (palm nut) wey person get, e no leave am make e roast for fire: meaning say the only thing wey person get, e no go leave am make e lost
My people una well done oo na my own yarn for today be that.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
make una take a step now cos monkey no dey see banana chop without climbing banana tree, if you siddon for one place dey await miracle, na der old age go meet una, so make u take a step now, the first step is the hardest, but when you don' take am, d lesser the difficulty wey you go face and the nearer you b to success.
my shout-out goes to all of una my personal person @shemzy @gprince @pearlumie @ehisoria @sparkles @kokogbona @morahn @illuminatus @hornblende and to the others too as my hand Don dey pain me, can't type all of una names
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
I sight u
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Your steemit name suppose to be sparkles o, rosyblessing no dey com my mind at Al, na sparkles I put.. Lol
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Lol
No matter my guy
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Holla Holla for everybody wey standa gidigba for this way. Happy Sunday. The Lord is our muscle. My own motivational quote for today be "temper hot, temper hot, e no fit cook indomie".The real marraz be say no matter the degree of your vexpa e nor get any benefit so na to dey do jeje unto say life nor get duplicate.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit