My people, my people
Happy new month o
I dey wish una better better things for this new month
Today na Friday, I wan make we talk entertainment gist. E be like say dis 21st century dey carry madness come, we don too copy yanki people so tey our own madness wan pass their own.
Source
I just dey luk pictures for my Instagram, I come see this picture, I come dey wonder how wizkid go dey hold mad woman for stage, how d mad woman take enter. I say make I read the tori, na so I just read am come see say na our own Tiwa savage wey dey stage for U.K.
Ahh, Tiwa don dey mad? She even put chain to complete am..
The thing wey tire me be say, some of our youths come dey hail am, some pipo even dey talk say if na Beyonce or Rihanna wey wear am we go dey hail them, but we no fit hail Tiwa ... Which kind talk be dat? Madness get country?
I feel say bad thing na bad thing, abi no be so, my people?.. Wetin una think? Make una come chook mouth for this matter, this kind thing wey Tiwa wear, e dey good? Even if na Beyonce wear am, e dey good?
Make una come talk, I wan hear una own today..
This one na free madness part 1
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Brother, how we go do am na
Na as we see am na so we go take am o
Make she dey mad dey go
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Abi o
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
For this world morals Don go, people dey behave any how any how. But we no go fit do anything ooo, God created this world with a free will make only him fit do anything. Na madness na em this world like now pass Godly things.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Thank you say you chook mouth for this matter
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Happy New Month @naijapidgin. Improper dressing don turn order of the day for we country.
Tiwa madness don enter market. Abeg my fellow Nigerian youths, this kind dressing no be something to copy o...
Oyibo man talk say dress the way you want to be addressed
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Na so
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Tiwa!
A whole mummy!
Wetin we go call this one now, this one no good enough now...
I no jist know wetin to talk oo, when you dress like mad person go UK...
See make i no just talk, God go help our youth, help our country o
I just dey pass buy oo
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Nawa oh nah so Tiwas fashion sense don reach
Me I tire seriously
All dey tear tear for the bum short
Plus chain untop
Walahi talahi I am tired😥😥
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Lol, this trend is kinda old though. Well e no consign, na deir life dem dey live. I no fit get high bp ontop anoda person mata. This world get as e be now.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Nah Dem Sabi sha
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
I'm so happy to read your post,
Your post content is very good ..
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Omg! Which kin thing be this?
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
I dont altogether criticise artists and celebrities from daring some fashion trends.
My own be say,Tiwa big pass this kind thing,no be am suppose dey wear things like this. I been think say she sabi body shaaa but e be like she still dey carry small pikin head.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Tiwa e have mad.... Lol, this matter no be only tiwa e concern, na as our fashion sense don reach b dt, most of us don dey wear all dem these crazy person cloth, we come call am fashion. Na everybody e affect, Tiwa own just get more degree and she still come be celebrity, wey she suppose dey showcase good morals for us youths, but na wetin dey sell now be dis, so me no go too blame her, no be say she no get blame o, but na we we be d problem, sake of say if toh say na all dem dis yankee celebrities wear am, we no go too talk, meanwhile like @nmalove true true talk madness no suppose get country, bad thing na bad thing. Na wen we realise this truth, na den we go fit help dis madness situation wey dem dey call fashion.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Na so bro. i love naija because we here are in full of Talent
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
When I first see the picture the thing shock me too much. Everybody wan slay. This one na pure madness in the name of fashion.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit