My naija people I hail o.
We don land again with another better tori.
We here say snake swallow jamb money. Abeg, how dat one take happen?
Why our yeye politicians dey carry us play like dis?
Before na rat chase presido commot from office, now na python swallow jamb money.
How una take see the matter?
Wetin we as youth fit do to take stop dis kind nonsense?
Wetin be the way forward for us?
Abeg make una dey make una contributions breif. No need for long grammar. Lol!
Our discussion go continue for our telegram group. Remember say na there everything dey happen. If you never join, join here.
Our people for telegram talk say na dis people qualify to collect 50% of our liquid payout for the last post. @samiwhyte, @mittymartz, @oliverwilliams, @zizymena and @horlaide.
If you wan join begin follow make this kind decision, join us for telegram for here. We go dey start discussion around 10 pm everyday. But we fit adjust time to any one wey una suggest.
Na @ogoowinner choose dis topic wey we discus so. So, 5% of the liquid payout na her own. If you wan win the next one, join us tonight to discuss wetin our next topic go be.
Walahi, E no easy to pick this winners because everybody yan better for dat tori. We go dey use our telegram group (naijapidgin) to decide better.
Five people wey yarn correct things here go receive 50% percent of the sbd wey we go collect from this post.
No mind say ein small now, very soon e go big reach money wey our politicians dey share. Lol!
Abeg remember to follow this account, upvotes and Resteem.
Who fit make avatar for this account for us? Abeg show face. The other guy wey been say him fit do one for us, Abeg show face for telegram.
Na for telegram we go dey choose our topics. First person to pick topic wey others agree with go get 5% of the liquid payout.
Abeg all the naija pidgin lovers make do quick quick go join the telegram group for here.
Snake wey dey swallow ego..
As Nigeria don dey today, nothing say freak me again because weetin my eye don see my mouth no fit talk am
Nigeria wey be say witch dey carry mirror do snapchat, witch dey disappear but dem no commot this country go better place like singapore ,south africa or saudi arabia , them go dey carry broom dey fly and u wan come tell me say this witch no fit turn snake go jamb office go swallow money, hahaha I laughter.
dis part dey weird oo
Sebi na bank una dey pay jamb fee , abeg wetin cash come find gio jamb office , dis people dey kid us o
D snake wey cone swallow no swallow #36,000 it come be 36million,, Govt.suppose sue dem both the chairman and evrybody wey dey there office dey work.
Ma suggestions
If not be say all this govt. people get hand for the work bcos I know say d matter don die down as I dey talk ,them suppose sue each and everyone of them to courth and sentence them life imprisonment
Where u put the money?
How snake take enter?
How u take know say na snake swallow them??
I swear them suppose blast them.
And something is appening here right now politicians+ govt+witch = fooled nigerians..
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Government no go fit tal because na dem dey do am. d tin wey dey tire me be say dey o get shame to commot talk dis kind tin. Dey just fall hands for this computer generation wey we dey so, I tire!
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Adeola Samuel:
See na God fit help us. Becos if we believe say youth won change tings my people I no fit lie you nothing will happen. Becos we youth nowadays are after money, woman and all this yahoo stuff. Pls at the age of 23 na him Obasanjo don dey rule naso some other leaders too. Pls do we have youth at the age of 22 as minster or in power. But we youth no won die everybody dey run for his head. B4 nigeria fit change is when all poor can stand for their right we fight for right that's when things will change but who won die. Nobody so we just they hope Nigeria go better. Na everyday we dey hear news. herdsman dey there oh, Boko Haram dey there now snake don they thief money again for Nigeria. Hmmmm I tired oh.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Frustruation wey dey the countri don make our youth to dey put hand for yama yama. But if beta person wey carry naija for mind win the election, naija go better.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
better person nor go fit win o
you must join dis people before you fit win
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
When i hear the tori, I first think day na like joking stuff. Next thing, the thing don day trend for twitter so tay they even create account for am @nigeriasnake
Which kain story be that self. How they fit open mouth yarn that kind story for this age and century. Small time, they go say cockroach don chop all the money for Central Bank or mosquito no allow police do them work wella.
I just day wonder how outside people go day look us. Imagine say you won go collect visa and the interviewer notice say na Nigeria you for come. He go day look you like one primitive person.
They fit even give you aptitude test like:
If a money mysteriously goes missing, what probably happened?
A. Theft
B. Negligence
C. A snake swallowed it
Anyway, if una know anybody way day train that kian snake, abeg, make I know. I no won use am thief o. No for my guys them way go get alert and no go gree pay me my money.
I don talk finish.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Hahahaha! Shame din dey catch me for this countri. Dey don fall hands finish for wia oyinbo people dey. I sure say our brodas wey dey that side go dey shame to dey waka for road. As our countri be so, na Baba God go help us.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Sha this story just dey trend anyhow for Dis our country . The funny thing just like I been talk before be say last last we go still swallow the Tori dis officials dey tell us. After all some go say 'wetIn we go do'?
Na dere I come enter, but fezz make I tank you @naijapikin for bringing this tori come here today.
See the problem wey we get for this country plenty ehhh setey to remedy am we go need better hand of God for our matter. 😢
But mostly, e dey because na the wrong people dem dey put for dis offices. If u wan do finding, you go realize say the person wey dey handle Dis money issue for that Jamb office sef no fit even study anything related to handling(Business management and the likes) dis our money sef wey our people don dey use write jamb tire. 😂😂😂
So first ting I go advice make our naija government do be say dey should employ people based on qualifications and experience no be Dis slot slot thing everywhere wey come be the order of the day.
Make dem also tighten security level wella for all our institution wet get money matter involved.
And if dem no wan do like that make we remove them for office ooo put beta people wey go know watsup. How we go take do this one?
Make we get our voters card ooo so we go vote for the correct people were go fit handle this country's and our various states problems.
I also wan tell our youths make me join this 'not too young to run' policy ooo after all, we be the leaders of tomorrow as we dey sing for song and that tomorrow don land today.
Make we stand up and act, because we dey capable to lead and stop making only person wey fit be our great great great grand fathers/mothers lead us ooo Biko.
I rest my case. 😂😂😃😃😃
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Na true talk, na because say better people no dey handle the office wey dem supppse handle, na e dey cause all these wahala for our countri. Everybody for government get slot for e generation. Make youth commot for presidency, bEtter youth we carry naija for mind, no be yahoo yahoo youth.
You try!
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Oboi!!..naija don make me beta 4 life i swear. The funniest part be say the same people wey believe say snake talkes to eve no come believe say snake come swallow money...lol
I too love my country
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Lol.. Naija we dey.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
My roommate get person wey dey work for jamb, we call am yesterday. The lady talk say this tori happen last year, say the people wey jamb give contract to sell their scratch card, dem sell am finish come chop the money. Na e jamb people come call dem, come dey ask of the money, one talk say e househelp turn snake for night go wia e keep the money swallow am, the other one talk say thief jam am for road collect the money, burn em car. Na d koko be dis, make una no mind dose bloggers wey dey turn turn tori.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Wetin we no go hear for this country! Dis one be like nollywood. Abeg wetin dey come do d people wey dey give contract
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
I no know wetin dey do dem o. The lady no talk am. The money don go be dat.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Are you serious?
Lol my naija my naija.
Last last we go still swallow the nonsense story like d one our president been tell us about the rat Tori.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Omo, as i hear that tori, i shock! Which kin thing be this? Me don tire for this country self na em make me decide say i go leave this country go back my village before them go talk say na animals wan contest for the next election
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
If dem fit count animals join human population...
if dem fit allow animal to chop wetin man labour plant and cultivate
Tell me why animal no go fit contest?
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Hahaha.. Abeg where your village dey, no be naija? I wan follow you gooo..
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
My village na for abia, e no be naija abeg...lol
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Our naija country don turn to land of the comedians. Na so so we go dey disgrace ourselves for international community. This matter no fit happen if the country get ogbonge law wey dey punish offenders.
As for the youth contribution, we no fit start war for our country, na the best thing to do now is to sanitize ourselves and our country people on the need to elect better leader not minding tribe or race wey go get the mind of our country people for heart.
We don almost enter election year, make all credible youth go collect their voters card and jejely keep am for the election day. Na we suppose decide the person wey we want this time and we should pursue all those baba wey wan turn naija to their papa property away from the political scene.
ps :
I can't totally express myself using pidgin. Thanks @ogoowinner
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
You yarn better yarn.. Make our youths carry wetin dey happen learn better lesson, make we no fall our countri hand go vote person wey no go help naija. As election dey come, make dem tear eye.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Nawa o, the thing dey make me smile...how can snake swallow that plenty money. I no believe, i beg i sabi know how to chop no feed me. But if na true say the snake swallow the money that means one of the politicians don turn to snake be that o and later e go change to human being after getting to bush wey person no go see am again. Na wetin i fit yan be that o
Thanks for givin me chance to pit mouth on top the matter
NOTE THE RICHES ANIMAL IN THE WORLD IS THE SNAKE WHO SWALLOWED #36,000,000
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Hehehehe dem don chop the money.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
You dey underestimate the animals wey dey this country oh...see our coat of arms nah, horse dey, eagle dey, e don tey wey dem do dey rule.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Hahaha.. I tireo, e be like say we dey under animal association.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Hahaha! U know say naija too like film trick, e fit no be politician, e fit be person we dey work for jamb office. D thing be say the money don go.
You don try!
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Thing wey no fit happen for nollywood na en our politician dey for naija.. We go belief that one. E bad past film trick for movie
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
My broda! Our countri don turn to cinema.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Lol... Then dey act,we dey watch....
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Abio, make we kuku go buy ticket.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
No need,den dey do free show for d whole world to see.lol
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
lol movie dey learn work for where them politician dey
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Abi na... No need to think before u go writ script again,just follo naija tori,u go writ a very comic one...lol
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Lol, i nor even tink of that one before, na to just day act wetin dey happen for naija film don complete
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Lol,naso.... In fact d film go get part 100...
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Lol, them go use different names for the different parts
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
😅😅
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
This country don become zoo
Rat matter
Fulani cow matter
Now na snake
Nothing wey person no go hear
My country people i hail una o
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Lol! The thing tire me o!
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
I tire! Our government don see beta tactic to dey chop money. Efcc no fit catch animal na.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
For me o, dis matta e taya me o, how snake the swallow money na. Well, my own talk be say mek them look for the snake, becos wen snake swallow somtin him no fit move until him vomit am, so mek them look fo am o.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Haha! The snake na human being, the money don go.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Naso o...DAT yeye snake wey our politician say e swallow 36 milla must vomit am,after we don finish dis NPC ,today na today
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Hahahaha! Toh, snake say dem lie against am na. Lol
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Hahaha! Animals we dey naija go soon form association for the lie wey people dey put for their head.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
The animals for this country sabi better, cows dey find colony, rat pursue presido comot, snake swallow #36 million (abeg if una see am, mae una tell say I dey find am, I wan collect my share), elections don dey near so, make another member of their kingdom no come carry ballot boxes comot polling centers.
Make we the youths participate, get better for mind and forget this chop make I chop attitude wey common for Naija.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Abio, make our ballot paper no come disappear. If to say our youth go put mind together do better thing, our countri go better.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Lol that is naija for u.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
we dey always represent
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Dat one no surprise me at all. If rat fit pursue our presido for office why snake no go fit swallow milla.
You kno say nollywood attention dey on lovey lovey movies for some time now. Now na time time for dem to come back to our own way of reasonig.... Back to the days of blood money movies.
Abeg who fit to remember me that movie way cat dey make money disappear that year? I for lik watch am again make I for see the possibility say snake fit swallow milla when no be food?
Abeg...Ejo...Biko...Da"allah..
#OurMumuIsDo
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Hahaha! No be small thingo, na too much naija movie dey worry naija. Very soon dem go use dis one act film.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
yes o, if sote i be film maker by next week the film go don come out
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Funny.
Abeg I be new member for this community
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
This kind thing weak me oo
I never hear this kind drama before oo
And they only suspend her....
We no longer have arm robbers but snakes
When the major things and competent people no dey the right place,this is what u expect
Okay lemme sha go and start training my own snake oo😂😂.....
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Lol. No go train snakeo, make dem no come catch you. Make we dey ready, go vote better people next year.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
them no wetin dey dey do
when he go resume now you nor go know, just dey watch
mata go die now
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Well, me i believe say na how deep kwarruption don chop our dear obodo naija becos if you follow the news well, this one no be dem big belle politician hand work o, na some people wey dey work for jamb wey dem dey sell scratch cards.
I believe say if we fit make people wey in charge of things like money and public service dey more accountable, and make we try automate some of this processes, our dear obodo naija go start to dey carry nyash small small.. Gbera!
Una thank you oo
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
True talk.. But if to sey na beta government, dem go dey check everything wey dey happen for d offices. But corruption dey everywhere.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
LOL! that a big lie....snake swallow millions...naija
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Our contiri. Lol!
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Nor be small lie o my broda
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
I HAIL UNA NIGERIA POLITICIANS
Abegi na where snake set swallow money??
When dem sama me dis matter,I tink set na yawa o, na ein I cun see am with my koro koro eye for news e cun b like film. The tori ehn,e weak me enter my bone.
So I believe set dis snake go dey fresh for body now...As this matter dey go so,my mind dey tell me set na another embezzlement dem use knack us for face.
Our politicians dem,tiri gbosa for una,na don try for this snake matter, and dis snake wey dem dey talk so,I sure set na one person dem dey talk so...no b set na real snake..the tin wet I know say truth truth go soon come out,and we go catch dat snake wet swallow 36 millions... If dem no investigate this matter well well,maybe later na fowl,lizard,mosquito go dey swallow billions.
My country pipu,na God go save us oooo,since our Broda RAT don pursue our pressi bayii
I don drop my tori again..
#i still be una boi @badmusazeez
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Haha! I just dry wonder how mosquito go be if e swallow money.. Na so we see am for this country, anybody wey chop money go dey call animal, the thing tire me. One day we go hear the truth.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
The snake the mother d papa d family the bush e stay d road d bank d account number jamb office jamb money d person wey comot d news d official site that promoted d story infact everyone connected to that snake are MAD!!
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Lol... Make baba God help naija
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
why our ogas wey dey top dey do like this nah.
so just because animals no the talk Na wetin make them wan use animals now to the lie lie. Before nah rat for oga presido office, now na Snake for jamb office.
as e b like dis animals no dey free again.
who sabi d animal wey go carry ballot box run 2019. This our country no dey help us o.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
The lie no be small lieo. The thing tire me, make una dey ready for 2019 o.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
naija na animal kingdom now o
every thing the happy by animal
make we dey see which animal go be next
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
This my country Nigeria matter eh tire me like say make I run commot go another place but I no go go anywhere we go tanda for here until d country matter change "we die for here".
This money and snake matter eh as I dey hear am e d dey me like film weiting d happen for film nah for naija e d happen for real like.
Dis APC people don too use us play ten ten and nah because then see say once Dem lie one lie naija people go collect am Dem no go do anything about am (like Charlie boy talk am "our mumu don do")
Make we youth stand up fight make all dis play play talk stop abeg e sure me say dis kind thing no fit happen for yanki.
Make I even asked this question how the Money take d office wey Dem no put am for bank.
How d snake take enter d office wey b say no body see am.
Abeg dis one nah big like wey APC want use chop our money run again like all the once wey Dem don de do
ABEG PEOPLE OUR MUMU DON DO!!!!!!
Make we youth open our eyes
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Our government think say dem fit talk anything make we believe. Whether na snake abi na human being, the money don go. As election dey come make everybody shine eye wella o.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Maybe dem think say people nor go school, how snake take swallow money, e nor possible
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
No mind dem. Our mumu don do.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
na we dey make body dey sweet dem, na to ignor dem nai sure pass
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Hmm! d matter tire me o.
Shame no even catch dem to com talk say snake swallow money.
Nigeria don becom animal kingdom,only God sabi which animal them go frame next.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
I tireoo. The animala don tire sef, na only God go save naija!
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Naija! Naija! Naija!
How many times wey I don call your name?
Why e come be say na only you wey go fall inside pit, leave climb-comot wey you suppose climb comot begin dey dig am with shovel? Choi, our mumu never do ooooo, e don dey multiply sef 🙆
Nigeria ooooo, so na here we don reach? Na so e go dey be? Snake don dey chop our money, rat dey chase our president, e remain make goat chop our Constitution na 🤷
Choi! Nigeria, we hail thee!
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Brother wen budget go loss again them go say na goat chop
Useless set of people wae de power
The person wae anounce am no get small shame for body.... We Cary power give cow to rule us 🙈🙈🙈🙈🙈
I go finally comot d country
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
My broda, na so me dey wondero. Person wey dey announce am shame no dey catch am? D tin weak me for body.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
My broda goat too big, e fit be cockroach. Hahaha!! Abeg make we ready our voters card, make we fit vote government wey go commot us for pit.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Oga Oloyede no go wan try rubbish na, if na him chop the money make him vomit am.
I dey sure say na for 2019 election, na why dem talk say na mystery snake swallow the money.
This APC just legalize corruption and we no fit do anything. Time don come, this yeye thing must stop. This na the time wey our youths suppose be on their toes. We no do mumu mumu again.
This party wey no get human feelings must commot, make better person come in.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Na wetin bad government dey cause. Time don reach wen our youth go shine their eyes well well, make we no dey fall our hand again.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
but na which party come better na, all of dem na almost de same, before election dem dey be like messiah but after election na storry we dey hear
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
We need God my dear.... All of them be craze ppl jare
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Yes o, God really needed
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Me - receives call Hissss, Who is thissss? Caller - I am the Jamb Director in Benue. Please we need to talk.
Me - hiss, talk about what? Caller - The N36million na.
Me - you for dey for me, when the snake dey hunger oh.
Ever since I swallowed N36million, I dey see a lots of posters saying wanted. Please humans, is this how you people dey
suffer when you na become rich and popular?
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Haha! The snake don become celebrity o. We go soon hear another one.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Human nodey swallow money again na animals dey do am
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
I tireoo!! Na d new style be dat.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
na dey collect the money
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Congratulations @naijapidgin!
Your post was mentioned in the Steemit Hit Parade for newcomers in the following category:
I also upvoted your post to increase its reward
If you Like my work to promoting newcomers and give them more visibility on Steemit, feel free to vote for my witness! You can do it here or use SteemConnect
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Nothing wey person no go hear for dis our country so, me first think say na play wen i see d news, how snake go dey swallow money?
Na wa ooo all dis our keaders just think say we no get sense, so snake no see other things to swallow, na to swallow money, e no come swallow small money oo, #36 Million, no b small thing, where d small from come, wetin dem dey look till e swallow dt kind money?
Make person no deceive us jare, small time now we go hear say rat, cockroach, mosquitoes sef dey carry money comot.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Hello my country people shey una don forget say na nigeria we dey so?
Those politicians dem don lie ontop people head finish na so dem jump enter animal kingdom. How snake go swallow 36million?
Diaris god oooooo
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
you see ehn when i first hear dis tori my body first weak as in i no even fit go lecture dat morning bcos i really really no like to dey hear stupid things i just dey reason 36 million naira SNAKE!!!! ahn ahnn shey dem think sey all of us wey dey dis country be fools abi wetin dem dey try talk when i hear am i con start to dey question my intelligence bcos if the office wey organize my admission fit talk sey snake swallow money den how i take sure sey 2x2 na 4 then d tin come even light for my head sey wetin d money they find for office shebi na online them they pay so how the money come turn cash bcos na d snake matter everybody dey talk nobody dey ask sey why d money dey there in d first place and i don notice dis thing for this country dem go talk about one big money for news and after dat one like dis nobody dey sabi wetin dey do that money after dem don see am from my heart i wan comot this country make i no come back but i alsodey reason am sey if everybody comot nobody go remain to make this country better so no i don tell myselfsey any little chance wey i get to make dis country better i no go waste am i believe sey i gat do this for my children i want make dem come meet naija wey don set make my generation no struggle like i dey do for this country once agin i dey thak you all for thischancewey una give to telk God go bless all of una thank you @ogoowinner thank you @naijapidgin thank you @steemit
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Nothing dey new for naija again hate,
Pls leave matter for matias.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Nothing dey new for naija jare
Abeg leave matter for matias
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
My omo nija i hail thee
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
I for like get like 2, abi how una see am ?
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
This matter simple. Our president na nama e dey rear. Rat follow leave for him vila so why snake no go swallow money? Dem don talk am say na zoo we country be now and now the zoo animals don dey show themselves. The only way to stop dis matter na to use social media make our naija youths know say our mumu don do. This election wey dey come make we use am put people wey still get strong body wey fit rule us without mago mago
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
The countri dey bad everyday, na so we go dey hear new tori everyday. How we go know person wey fit rule naija better? Na only God go help naija.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit