My country people I hail unah!
How unah take the hold body for this we change wey dey happen everywhere even for crypto?
As d matta d be we Don come with another ogbonge Tori the one wey concern me and you well.
Nah so I wake up one morning hear say one of the big boy wey get the biggest social media ban crypto currency advert for em social media "Facebook".
Immediately wey him take am nah so price Bitcoin go down straight nah so him brother steem and steem dollar self wear cloth follow am.
Make we reason that one finish nah em their brother Google open mouth yarn em own say himself want ban the advertisement for em network.
Make e no be like say nah only Dem Waka come nah him even Twitter come join for the matta.
As all this thing the happen nah so Bitcoin and em brothers the suffer am.
As I dey talk to unah so eh the matta don tire me.
Abeg my country people how unah help me reason this matta so?.
Wetin concern all this people and our crytpocurrency wey we dey flex?.
Unah think say this fight on top crypto currency them go fit win am?.
Unah think say steemit go go one day?.
Wetin unah come reason say go fit be the way forward for this matta?.
Abeg chook your mouth put make e b say we for no lost
The matter wae jam us today na @oliverwilliams bring am and na @mittymartz edit am
Avatar designed by @mittymartz
Abeg na badt belle people way no really dey benefit much from cryto dey para for inside d mata so oo., many of dem no get share inside.
But i blive say cryto never dey loss any for d main time since some kin big big names dem don involve beter baar (money) for inside soo,
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
You serious??
So, na all this big boys them be the village people wey dey put sand sand for our garri since?
How me I see am be say:
Crypto don dey affect them, people no too dey use their platform again as the thing no dey give money na. Na Crypto site people dey now.
I no fit remember the last time wey I enta facebook.
But, me no con know wetin concern google o.
If Google enta the mata, na big war we enta so o.
E dey pain me say the fight no go be physical fight. If not, na bottle we suppose break for their head. (Na joke I dey o).
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Omo, this matter weak my nyash...
I no even know wetin concern those yeye people.
Wetin me i know be say na noise them dey make, dey wan chop alone but the God of steemit go fight them..
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Well them no get say
Too much people Don dey use crypto
And I sure say crypto go soon pass them hand
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Na their paro bidat make e no affect steemit o, any way sha with all this nonsense wen dey go on steemit sef con increase their pay out, chai! Na dis wan concern me.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
na wa o, wetin con be the reason for the ban na, na so i dey listen to news wey central bank talk say them hand no dey this cryptocurrency matter, na in i con begin to dey wonder. wo it is well jare, cryptocurrency all the way.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
The tin don tire me we just dey hope here ni
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Na yawa b dat ooo
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit