Ma pipu my pipu how una dey, I trowey salute give una oooooooo.
Make una all welcome to our ogbonge naijapidgin blog.
I greet una Happy Sunday o, nd aw weekend dey be for una side?
Another week don end and another don begin. Make una jex dey shakara dey go.
Wetin wan happen today like dis?
@naijapidgin don carry one ogbonge contest come ur domot. I no think say dis one be contest oo, bkos u go jex write shikini story win awoof.
Nawa ooo, @naijapidgin una dey try, I bow for una, bcos u still dey give awoof SBD for dis kind dry season, kudos to u.
Hmmmn, As d mata dey be, I know say d topic don dey hungry una....
Make una all cool down make we talk the rule of d game. Make una no joke wit our contest, bcos we no dey carry upvote do am.
Make I sharperly yarn d rule, topic go follow, plus rewards.
RULES
- Make una upvote dis post
- Resteem am
- U must don dey chat tey tey for we group no be today. If u neva join click here
- Ur entry suppose be at least 87% pidgin
- All words no suppose pass 100.
- Enter d contest
- If una no follow any of dis rule, make una jex forget d contest.
Hmmn, wetin be d contest self?
Before i yarn d topic, ur 100% creativity na im we need.
Topic
Just make us laugh in 100 words........
Shikini mata.
Before i commot
Make i yarn d reward attached
Most creative gets 1.5 SBD
More creative gets 1.0 SBD
Creative gets 0.5 SBD.
Na so dem say make i talk am ooo
As it go be: we go announce d winners for night for we blog on Wednesday.
Na the one wey make the admin them laugh tears comot for eyes go win.
Una good luck
Na @horlaide and @zizymena na im say make una play small.
Na @mittymartz na im design our avatar.
This one make sense o
This na why i dey gbadun una
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Make i make u laugh in 100 words?
Just waka come like that, na the church way u wan go be that abi. Aproko no go kee you.
Ohk, i remember this funny talk way one of my lecturer talk.
We dey for one meeting, we student na so he con shout!
Dress well you girl!!!
'Stop dress like obanje' yeee
'Some of you dress like u are possed'
Jesu🙆
This one plenty for ear.
Na so one girl way be like mami water just walk in.
No laugh oo, na your laugh, abeg give me my laugh back.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Omo no be small thing oo, nothing wey steemit no go turn person to, I no say I go too read plenty comments today, all na hustle, man must survive... Hehehe..... after na, one yeye old man go come talk say we youth dey lazy, no be him fault, if toh say him dey steemit he for know say boys are not sleeping.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Happy Sunday my naija pipu. I hail ooo
Make I laugh una small
Na one teacher for primary school ask question say anybody wey know how many pipu Jesus fed with 2 fishes and 5 loaves of bread go collect two phones.
Naso one boy come answer am collect the phones. The teacher kon talk say make the boy ask him question make him collect the phones back.
Na him the boy say make the teacher mention all the names of the 5000 pipu Jesus fed.
Lol
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
For dis life I no dey believe say dream Na real becos I go sleep come dream say I get money come wake up with no money ...abeg make Pesin con sleep dream say him piss con wake up see showers of blessing for bed
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
I greet una say happy sunday o,make I make una laugh troway sadness
Na one lecturer enter class talk say dem get test make dem tear paper say na two questions e go be. Na im de lecturer start. Number 1,write una favourite food,naso all de ladies write shawarma,pizza etc, the boys dem write eba,fufu,amala etc. Na so the lecturer say number 2,make una write how dem dey prepare the food. Come see paper wey ladies tear change their food. Lol
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
na buhari I dey search for, I wish I can tear im face with slap, shey e talk am say the youth dey very lazy, I no fit blame am, na bcos the ac wey dey blow for im house Don blowaway all his common sense. Yusuf dey asorock dey enjoy, y buhari no fit push am for street and define laziness....
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Sebi dem say If you dey sell cloth, you suppose dey wear better cloth. Make dem no say, Yes na cloth you dey deal with.
I check all the comment for here con see one guy wey dey sell upvote. The guy dey reputation 25, with $0.03 as payouts. Abeg, shey na joke be that one?
I for make una laugh this morning, but, I dey vex. Na since day before yesterday I dey expect light, dem con finally bring am come for midnight o. I cool down chat wella with hope say I go plug my phone con sleep.
I wake up this morning con see low battery.
My people, I forget to on socket, I just plug the phone go sleep and NEPA don carry light.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Why be say baby everytime wey rain fall na him we dey drink tea? we dry copy copy our European people sote even for hot sun, some area boy still Fey smoke ganja, I dey hail o, as buhari say una youth nor ge work, anybody wet wan weed my farm for free?
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
This contest make sense, but i no go join this one. I still dey reason una country mata.
Abeg make una help me tell Captain P aka @ceepee make she show me road to comot naija
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Lol this one serious ooo so na from church u begin type this thing wey long pass river Jordan...u sure sey u know wetin dem preach' Baba make I try my best to change unna face...na only wen rain dey fall babes go dey see d*ck as weather
Lightening go strike dem go think say na there boo sperm pour
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Naijapidgin una do well...na my entry be dis
As i don grab my guguru lyk dis...abeg who sabi where dem de sell drink whe i fit use flush down my guguru make man no go choke...because na here i wan sidown put till wednesday night since i be lazy nigerian youth...this wan go bad pass night of a thousand laughs...
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Hello my people...how una dey?
I just the come back from church now now self
And hunger the waya me but i go just drop my own funny story sha...
One day wey i just the come back from work, i say make i kuku ma trek comot road as i no see keke... As i dey go na him one man stop me say him the sell medicine wey dey cure rashes, ezyma and pimples, say if i rub am, 2days na him en give me say everything go clear sharp sharp....
Lol, i come laugh, i look myself as i fresh, no pimples, no rashes, no ezyma, i come look the man see how rashes full him face...na so i gently tell am say,
Bros abeg who the sell medicine for rashes and em sisters no the use am for himself?
I come tell am again say na him need the medicine pass no be me...na so i waka leave am there..
Make i go check my rice before the thing burn o 🏃♀🏃♀
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
My people I greet una well well o
Na my entry be this:
This idea of people when dey ask question when Dem know the answer already who start am sef?
The other I just dey stroll for my street with my headset dey hear correct gbedu, naim one mumu when God go help me punish con see me dey ask me "afa that you cloth na red?" I con answer am "Nooo... na immaculate white, you fit even call am sky green" da wan commot another wan see me dey ask me "oboy na headset be that?" Trust me I nak am back "Nooo... Come on.... Na 4 plots of land be this now,..."
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Ahnn and i no get wetin to write oo but afowalex u be confirm ode how you go plug something forget am for light and you no on socket sey una don see why buhari they talk sey our youths them lazy die.
Make una come carry afowalex go give buhari oo cause na him lost son be that
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Jesus Christ!
Walahi, e pain me sha.
I just dey see this comment.😂
Na thunder go fire your yansh.😀
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit