My name na Inyang Michael but my hommies dem dey call me Classic Mikel.
My people i dey hail una, na me be @classic717 for steemit, d guy wey sabi body and I dey give my niggas excess joy.
Make I no lie give una, when I never join steemit, I been broke wella, that time i bin dey beg people for chop money and e come be like say na my own bad pass, I bin no get joy for my life i swear.
E get one day eh wey my twin brother @mritsnobigdeal yarn me about steemit, him bin tell me say we go begin chop money, him talk say we go soon blow, me wey be say i no dey tutu dey believe that kind yarn, I bin no take am serious.
My country people i bin dey dull ooo, I bin no sabi say steemit na for real.
My twin brother bin come helep me do registration, as i begin write for steemit, people bin no dey send my post. My twin brother bin dey encourage me to dey write say one day I go begin chop money.
As i bin determine for my mind say i no go give up, one day, steemit come change my story, as i dey like this, I no dey broke again, I no dey beg money, I don begin helep people, I don begin give my niggas dem excess joy because of steemit.
I don become senior man for my area.
@ogoowinner wey carry dis pidgin contest come, I tuale for you.
You be better person and you sabi body over.
One love nwanyi oma.
Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
Oboy, you sabi book no be small. Weldone!
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit