PIDGIN CONTEST @ogoowinner: Wetin dey sweet me about STEEMIT

in npc •  7 years ago  (edited)

@ogoowinner! #supersonic babe! Twaile for una oooo. Owo meji loke for you; one leg up! I throw way salut for una! Madam you too much ooo. Wetin you do make me know say pipu dey think for this our country wey some pipu don give up.

IMG-20171205-WA0019.jpg

I go follow una yarn this one oooo. Make I talk wetin dey sweet me about Steemit. Chai! Na golden opportunity be this ooo make I talk wetin dey sweet my belle

Eh! Steemit don dey totori my body since I join ooo. You sabi our naija country na and how strange it dey to just sidown for 'one corner'(no be the dance o) for your room dey type your thoughts dey make correct shangiliti money.

Hian! The dey wey my friend @tojukaka yarn me about steemit na im my eye tear say I fit make money ooo. I don waka waka this entire ibadan town on top say I dey look for job. Na im I just sama this wonder wonder steemit. At first I dey fear say na wayo, I dey wonder say how I go make this kain money just from wetin I sama for phone. Na im in 1 month I don dey see plenty changes for my life! No be small tin oooo!

*I don dream say I go be confirm blogger one day wey get correct content wey people go dey follow. Na im I just get free space on top steemit to dey tell my people even oyinbo man about my yarn. The way I don dey write don better by far

*Chai! For this ogbonge platform, I don make plentiful friends wey dey follow me dey check on me everytime. This place just dey sweet my body wey I dey yarn everybody make dem come better their lives better this community.

*Ego sef don dey enter like water! My life don change faya faya. I sabi say me too get money for account. I fit do things without yawa!

My sister! The tin wey steemit do me sweet me ehn! My body dey do jolo! God bless @ned for this community oooo.

My sister @ogoowinner! Your head dey dere baje baje! Nothing do you! God go sama you blessing left right front centre!

I love you!!!!

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
Sort Order:  

Good post

Thanks

Welcome but u look ghanaian

Hian! I be full blooded naija babe oooooo! No let look deceive una

Lol....Omo Ghana

What is the language a pidgin of - if you can say so? Which languages are mixed?

It's English and the language called 'pidgin'. It's an abridged form of the English language in Nigeria

OK, thanks. I have heard of a pidgin Language in South Africa that was a combination of English, Zulu, and Africaans. But this is mainly English then. I can see it when I try to read it with a Nigerian accent :) (I admit that I am second guessing half of it)

All of una just dey make me proud. Better entry my dear.