the creed of life contest @ogoowinner

in npc •  7 years ago 

Creed of life pidgin Challenge by @ogoowinner

I believe say e get different ways wey dem take train us so i no fit judge my fellow human.

I believe say life na do your own make i do my own,no copy copy

I believe say weda you be white or black,na same blood dey flow for our system.

I believe say everytin wey start today get him expiry date

I believe say weda you be lepa or orobo,you get your own match

I believe say every Mike Tyson go meet him Hollyfield

I believe say weda you black or white,na the same God we go queue for him front for judgment day.

I believe say weda you be porshe or pako,we all must enter toilet shit.

I believe so much in packaging,iron my cloth use starch hammer am because i know say na as you package dem go take address you.

I believe say na one Baba God we dey serve,,weda you be cele o,moslem,JW and every.

I believe say e get reason wey we come dis world and everyone go fulfill him own purpose.

I believe say no mago mago to success instead make man pikin work hard o.

I no get money yet o but i believe say if you chop alone you go kpain alone so make person dey give small out of little wey him get.

I believe say make man no pay evil with evil.

I believe say na to get positive mind better pass,no allow anyone tell you torri wey no go ginger your hustle..

I believe say God dey o and he dey hear our prayer even the ones wey we put for heart..

I believe say e beta make man pikin dey do good always because every good get him reward.

I believe say make man no envy o,instead make you pray cos your time dey come too

I believe say as you lay your bed,na so you go sleepu on top am.

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!