The Creed Of Life. (NPC Episode #3). @ogoowinner NPC contest.

in npc •  7 years ago  (edited)

first first make i throw away salute give our madam @ogoowinner for this competition were u carry come Steemit.
I believe say everybody get right for people to see dem,hear dem n love dem.
I believe we all na equal.
As i dey like dis i believe say this world big enough to contain all of us.
I still believe say all of us sabi something for one part of our life.
We all dey unique n special.
All of us get good side n bad side,but we dey try hide our bad side n cum show only the good side.
He knor matter our race,religion and social status all those thing na noting becos na all dis contentious men na him create am to control us, cause wahala and wash our brain.so as for me I won b human first before anything.
I go treat everybody the way I want them to treat me.
I knor go dey vex for people becos of who dem be, but Wetin I want them to be.
I knor go follow for anything wey go cause wahala to person.
I nor go allow envy, jealousie and long throat they control me.
I go do something for this earth wey good wey dem go use remeba me before i commout for this earth
I go try dey strong when wahala,badluck and problems show me their face.
I knor go dey fear fear anything.
I knor go dey allow all this bad thinking to dey worry me instead I go dey think good things becos dat kind thinking ney him make sense.
I knor go dey form like say I be anoda person. I go show ma self any where I dey.
I believe say i fit bring change,if i try very hard.
I believe say dis life na jejeje no b to dey rush becos i knor dey follow anybody rush.
Me b person wey no like wahala.
I believe say he good make we share the little wey we get with People wey nor get.
Me ney dey like carry person for mind i prefer to just forgive.
I like love oo.
I dey for mercy.
I dey for justice for everybody.
I believe in all of us.
I like to live life knor be to just dey exist.
I Alex Okolosi go follow dis creed for the rest of ma life.


credit

This picture wey we see so na our main artist (AYODEJI IBRAHIM "WIZKID"BALOGUN)

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!