My NPC Entry for Today with @ogoowinner: Wetin Friendly enemy don Take my Eyes See

in npc •  7 years ago  (edited)

My country people , I don come again with my pigin tori, this one na about friendly enemy; na those people wey go dey do like bros J for your face, but for your back na dem be the winch wey dey supply you NEPA bill. Dem be correct bad belle.

Before I start, make I use this chance thank @ogoowinner for this platform wey dey push nigerian pigin forward.

Now to my tori for the day, when I been dey university of Ibadan (Greatest Uite!!!) Na me be the speaker for my faculty legislative council, that kind position dey attract all this friendly enemies. Dem show me weee, my eyes clear.

We go don plan issues wey we won discuss for house, dem go go my back go tell the opposition wettin we discuss. A lot of issues shele wey I no go fit share for this tori, my people this kind people dey dangerous. At one point this people go behind me dey move for my impeachment, but thank God say meself no carry last for the matter, na him dem no pursue me kommot for sit.

Last last, this kind people dey everywhere and everyone get dem for their domot. Shine your eyes well well, no talk wettin u no go fit defend, because na dem go still carry wettin you talk around. Na how I lean to handle to handle them.

Na one garden for conference center, Univeraity of Ibadan be dis
DQmX3ysZ5yF2RpQYzKXeXyiLfZsAVumkHRTD3THZLSSMMcv_1680x8400.jpg

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
Sort Order:  

That is weird.