NIGERIA PIDGIN CONTEST: WETIN FRIENDLY ENEMY DON DO ME

in npc •  7 years ago 

My country people, I hail una o. Today Tori no be small one o, Na something were don do almost everybody. For this life, no too the trust people, them fit one fall your hands.


ibp2.jpg-301-570006f6c178e.jpg

image
plazza at uyo

For the compound were I been dey when I start university, e get one guy were been the follow dey de place. At first the guy been the form my right hand man, him the show my place come chop when I cook, him the use my soap, him the use my polish and sometimes him the follow crash for my house.


Base on how I been the live for the compund, I no the get time for anybody even when landlord the carry wahala come I the always look for ways avoid am.


When things spoil for the yard na me the always repair them most times. So landlord come the show me maximum love. At a point landlord come connect him generator to my room so that when him on gen I go the get light. And since I dey stay one room I no been get kitchen. Landlord come fix up kitchen give me. I no know say all this things the vex my guy.


This guy now for my yard, when we yarn go carry our talk go the yarn landlord. At a point him come the tell landlord say people too the come my house and because of that I fit carry wahala come the yard.


One day me and this guy just finish to yarn with me, I come prepare enter school. As I reach, my classmates them yarn me say class no go dey. So I rush enter back house. As I dey inside I hear as this my guy and landlord the talk, the guy the yarn landlord plenty things about me. Him come even talk things were I no do and at the end him yarn landlord make him commot me from the house once my rent expire.


At that point I come commot from my room, as the guy see me him know say I don hear everything, my guy no fit look my face again. To cut the long story short, after everything my guy come the beg me say make I no vex.


Finally for this life most people were the laugh with you, Na them the plan your downfall.


As e the hot make I throw-way salute give my madam @ogoowinner and my boss them @ejemai, @tojukaka, @ungest and @biggijay, your boy still dey loyal.

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!