Naija Pidgin Challenge: Friendly enemy, street wey one run me

in npc •  7 years ago  (edited)

@ogoowinner wetin dey there be say Baba God go wele you with ogbonge blessing wey go berekete sete your friendly enemies go ask you if repentance slot dey for dem.

My kontry people i troway gbosa for all of una...... GBOSA!!!!!!!!!!!
image.pngPhoto source

Ehmm, na me be the pikin wey him mama born without labor, i don show to yarn una about the street wey one friendly enemy run me.

But make i first talk the intel wey my p-man been dey always yarn me about friendly enemies, him dey always say "dem show you teeth no mean sey dem like you oooo, dem sey how you dey no mean say them dem wan make you fine oooo"

Wetin been dey there be sey, i been be senior colleague for the MUMU industreet.

Na jeje i dey my own for school ooo wey one senior come buy me rice and beans base on sey him like the way wey i dey waka jeje for school, him like the way wey my face dey very innocent.

Naso i chop ham the first day clean mouth. The second day i Chop clean mouth, drink water. The third day i chop clean mouth, drink water, use tooth pick gjoin.

For my mind i done get school papa, i no know sey na my advance payment for delivery w*ey i go do for outside school one week later i dey chop so ooooo.

Na im one day bros show with tintini bag sey make i keep the bag for one corner near one house like that as i dey go my own house. Him yarn me sey make i no open ham but I been form smart guy, i open ham, i see something wey dey like wetin my mama dey use cook party jollof (thyme). Na when one of my papa friend kash me i know sey when Jim Iyke get accident alone alone for express, nack him head for steering but doctoor bandage im leg, na camera man run ham insustreet.....

Na royal bush been dey the bag wey him carry gimme but since i been mumu complete and i been trust the guy base on friends wey we be, i think sey him go talk true but finally him kiss me like judas been kiss bros J.

But last last ehnnn after my papa show me lite love for house when all our neighbors don sleep, my brain been just auto-update sense.

I still thank Baba God sey i meet ham sha, him teach me ogbonge lesson, no trust people wey just dey buy food for you anyhow

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
Sort Order:  

Congratulations @euguma! You have completed some achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of upvotes

Click on any badge to view your own Board of Honor on SteemitBoard.
For more information about SteemitBoard, click here

If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

By upvoting this notification, you can help all Steemit users. Learn how here!

This project is worthwhile. Like somebody once said, 'pidgin English unlike people believe to be a misnomer is a veritable and qualified language for communication'