Hello Brosiee, Sister, Maale, paale. I throway salute reach every corner. Na me Mimy, I don show face again. This time around I wan talk about the reasons why Steemit take dey do yoriyori for my heart. In another words, because of my brothers and sisters for another side, I wan talk about why I like steemit.
No let this my style surprise you oo, I mean this style (pidgin language) Wey I carry come. Make una no confuse, no be Creole, na pidgin. The language wey we Nigerians dey take yan.
This contest ehn na our sister @ogoowinner bring am. She say make me talk why we like steemit.
Okay nao, before I pass where I dey go, Make I begin my own.
First, steemit don open my eyes Gidigbam. Before before, I no sabi anything about cryptocurrency. Wetin bi Bitcoin abi Etherum? I no sabi anything but now I don know say another world exist. I don know say no be only book, book, book. Life they elsewhere.
My Tori just dey start. Again, steemit don make me develop myself. Sometimes ehn, I go just sit down through my blog, my belle go come dey sweet me to see all the kind works wey I don write. Apart from say, steemit develop my writing skills, E don develop me socially too. E make me develop my communication skill.
See, make I tell una, steemit na Gold, because apart from the money, I don learn plenty plenty better things. See, Steemit dey make person sharp. E dey make person head correct wella. If evil dey come now, you fit quickly detect, sake of say you don learn a lot from all this SBD and Steemit Crisis. Also, I don learn virtures like patience, endurance and kindness on steemit.
Steemit brothers and sisters they look out for one another.
Financially, Chai! I remember before before anything wey I want na to take ask paale and miile but now Tori don change. Anyway, Make God dey bless us go na im we want because true true, we humans no deserve am.
This na be the reasons steemit dey take do Yoriyori for my heart. This na why I dey call steemit my sweetheart.
If you enjoy am, you sef abeg write your own!
Before I commot, I throway salute to all of una once again and for all the friends wey I don make on steemit, Baba God go bless Una.
For our Aunty Ogoo wey put up this contest, Sister, Your hand no go fall.
Una Bye bye.
Hi mimy. My friend mentioned that he met u at the delta steemit meetup. Me im just wondering y he didnt famz well. Pls, im ere famzing, so dat small love go reach my side. Well, hope id get to meet u in person tho. Now following.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
naso ooooooooo, pretty niga babe, steemit don do a lot of better for many of us ooooooooo.
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
nice post
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Uhm , so fine girls sabi tear pidgin too. Ogoowinner thank u for helping us catch them
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Asin eh
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Babe..you cease to amaze me...any ways I would love to learn a lot of things from you..I don't know how to possibly reach you...
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Woow..
Amazing....
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
A fun post and a beautiful lady :)
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Weldone dear @mimy a typical Nigerian beauty and brains mashup
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Fine babe, good skills
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Babe you too much. Thumbs up!
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
No be small, before who know wetin be etherium and bitcoin. Lol, tnx to our beloved platform..
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit
Upvoted! :-)
Hello my friend!
Lovin de lingo!
Flows like poetry to me...
thank you for sharing! :-)
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit