THE CREED OF LIFE: EPISODE 3

in npc •  7 years ago 

Hello I greet una all.
I go firstly like to thank @ogoowinner for this kind opportunity on this steemit thanks.

I @nikkibelle I believe say everyone get right to be seen, heard and loved.

I believe say all humans dey equal.

I believe say the world wey we live in dey big enough to carry everybodi.

I believe say everyone be genius even if na say for one area of life.

I believe say everyone dey special and unique.

I believe say everyone get beast and an angel wey dey inside of them. So go try my best to calm the beast come arouse the angel.

I believe say race, religion and social status be nothing but the creation of contentious men wey dey come dey control others, come dey cause strife and in-plant the supremacy mentality. So me don choose say i go be "human first" before i go be of any race, religion or class.

I go treat people as I will like make them treat me.
I no go react to people based on who they are, but who I go want them become.
I no go partake in no business or project that will cause harm to another person.
I go strive to understand people well well and I no go judge them.
I no go allow envy, jealousy and greed wey I go use control my motives.
I go accomplish at least one notable thing for humanity before I leave this earth.

I go try my best remain strong in the face of misfortune, grieves and sorrows.
I no go allow fear make en intimidate me.
I no go allow any negative thought make en occupy my mind; I go try replace them sharpingly with peaceful and creative thoughts as soon as they come up because I know say "thoughts dey powerful".
I go always be me, my original self and no photocopy of another pesin.

I go believe say I can make a difference if I come put in my best to any given task.

I believe say life is a journey no be race, so I will not permit myself to go into competition with anybody.

I believe in peace.

I believe in charity.

I believe in forgiveness.

I believe in love.

I believe in mercy.

I believe say in justice na for all

I believe in human race.

I don make the decision to "live" no be merely "exist".

IMG_4183.JPG
image

I, @nikkibelle Will abide by this creed all the days of my life.

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!