NIGERIA PIDGIN CONTEST (WETIN FRIENDLY ENEMY DON DO ME)

in npc •  7 years ago 

Calabar1.jpg

image
melinium park at calabar

My fellow steemians, we don come again with tori for naija pigin. Omor, Na this one sure pass. Thank you aunty @ogoowinner for this thing were you the do. When ever I the write for this our language e dey always sweet my belle.

Last year e get one girl were I been meet for church, the girl come the carry body show my side. So that e no go dey like say I too the form I come the free body with the girl.

I be person wer sometimes I dey always for get where I keep things. From time to time I dey notice say my things the loss and when I check for am for sometime and I no see them, I go just forget about them. So this girl one come the capitalize on that fact.

My things the loss like say tomorrow no dey. E get one golden chain were I get, I come notice say I never see my chain. We find this chain tire we no see am. After much searching we come decide say we go check again later.

This girl come comot to go buy something, Na it I say make I commot something for her bag Na so I go see my golden chain. I been want faint.

As she come back I show am the chain, the girl come the cry the beg me. I make sure say I go her house go check for my things. After the search I see plenty of my things.

After that day, I fear people o.

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!