The Creed Of Life. (NPC Episode #3). @ogoowinner NPC contest.

in npc •  7 years ago 

My appreciation go to @ogoowinner for this pidgin challenge you organize on steemit.

Happy Reading

my belif be say na everybody get chance to see, to ear and also get opportunity to love person.
I belif say na the same we all be.

I belif say this world wey we dey so big enough to contain all of Una

I belif say everybodi get in own talent wey Baba God give him

I belif say na everybody better and dey special.

I belif say we all carry bad things for mind and also get better thing. But me go try kill the bad things wey dey my mind and carry better thing wey dey there out.

I go to be myself and not photocopy of anybodi

I go treat people as i want make dem treat me.

I no go judge person for bein good or bad,

because na good i want for everybody.
I no go put hand in any bad thing wey fit cause kata-kata for another person.

I no go judge people because i know say finger self no dey equal.

I no go let envy, jelousy and greediness allow me misbehave.

I go make sure say i do wetin go make pipu dey talk good about me for this world before Baba God call me.
I no go let bad things of this world weak me.

I no go let fear take me as tight friend.

I no go allow bad thing for my mind, i go carry better thing like peace take replace am sharply because i know say, na wetin dey person mind get power.

Na my original self i go dey be always, i no go copy anybody.

I belif say i fit change this world if i work hard and given do chance

IMG_20171225_155621.jpg

I know say this life na like head, we all get our own, i no fit replace my head with my friend own, so i no go copy anybody.

I go dey jeje

I belif say make i dey share little wey i get with people wey no get atall.

I no dey carry person for mind.
I dey carry love dash everybody wey dey arround me.

I go dey carry help give people wey no get helper.

I go dey judge matter as the matter be.

IMG_20170820_112323.jpg

I ogunleye Dorcas promise to abide with this creed forever... may God help me.

Thanks for reading

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!