Naija Pidgin Challenge: steemit get plenty sweet package na why I like am

in npc •  7 years ago 

My country people I greet una oo, dey oyinbo wei dey dis yard, I follow greet una join.

How una dey? How weather dey do una for body?

Ehn...before I follow yarn my own tori,tell una dey things wei make me like steemit, I go like tell una how I bin take sabi this steemit sef.
IMG-20180115-WA0010.jpg
Na my guy @ungest o. I bin see for him WhatsApp tori,as him post new phone testify sai steemit dey pay.
Naso I come ask am wetin sup. E take explain every every gimme. Na how I take come here be dat.

So unto why me I like this steemit. First first, me just be "jolly just come" #jjc for here. E neva tey since I join, na one week just pass sef.

Apart from say this steemit na another way to dey make money, e epp pesin to dey sidon think wella, i swear. Why I tok so be say, before you say you wan post something,you must first know dey kind people wey you wan post am give to read, you go den begin to arrange your grammar so pesin go read am and grab.

Another thing wey make me like Steemit be say,na another means where pesin fid use learn wella. Cause as u dey read different blogs,or you search the tags,you go learn new new things.

You go even learn new cultures sef,know different places, read stories wei carry beta lessons.
IMG_20170808_094235.jpg
Steemit dey make you sabi new new pesin everyday. Like pesin like me,I sure say if no be say I join steemit,plenty of una for no know say pesin like me exist.
IMG_20171204_141614.jpg
Steemit dey follow teach patience join o and wetin oyinbo people call endurance, i dey teh u. Because you fid sidon type better something but get response Were fid make you wan run go back your village...lol.

Plenty things dey wei make me like steemit but I go stop am here.

Wan use this opportunity holla my guy @ungest for introducing me to steemit,even my guy @joecxt @zadic,una do well.

The fine people wei bring us this #npc, like @ogoowinner, the people wei dey make out time to dey upvote and comment on my post una do wella. Even if I no sabi all of una but with time we go know ourselves.

@willizgallery

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
Sort Order:  

See my baby

Bby love

Call my airtel line.. My phone Don spoil

Sure i will,no wonder i'm not getting response on Whatsapp

Call both lines please

I bow for ur pidgin babe...as e be sef I be learner for pidgin as I read dis post finish..
Mek we dey steem dey go jare!!

Hahahha, i be learner sef