I gree sey na everibodi geh right to be seen, heard and loved.
I gree sey all humans dey equal.
I gree sey the world dey big enuf to contain everibody.
I gree sey everibodi na genius in atleast one area of life.
I gree sey everibodi geh beast and angel inside dem. So i go try my best to tame the beast and wake the angel.
I gree sey race, religion and social status na nothin but the creation of men wey too dey vex because dey wan control others, cause strife and put supremacy mentality. So me I choose to be "human first" before i con be race, religion or class.
I go treat people as i wan make them treat me.
I no go react to people based on who dem be, but who i go want make dem become.
I no go do business or project wey go cause harm to another person.
I go dy try understand people, and not to judge them.
I no go gree make envy, jealousy and greed dey control my motives.
I go accomplish atleast one thing for humanity before i comot for this world.
I go try my best to remain strong in the face of misfortune, grieves and sorrows.
I no go allow make feae dey intimidate me.
I no go allow any kyn negative thought dey occupy my mind; I go replace dem immediately with peaceful and creative thoughts as soon as dey come up because i sabi sey "thoughts are powerful".
I go always be me, my original self and no photocopy of another.
I gree sey i fit make a difference if i put in my best to any given task.
I gree sey life na journey and no be race, so i no go permit myself to go into competition with anybodi.
I gree for peace.
I gree for charity.
I gree for forgiveness.
I gree in love.
I gree in mercy.
I gree in justice for all.
I gree in human race.
I don make up my mind to " live" and not merely "exist".
I @yahuzahope go abide by this creed all the days of my life.
https://steemit.com/family/@yssfashion/urdu-and-islamic-literature-in-the-indian-subcontinent
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit