Honestly speaking,Real Madrid deserve some accolades via say any final wey them reach they no dey lose am.
Well,na heart break for Liverpool fans,our Egyptian winch Salah,Jurgen klopp and Co.As dem no fit defeat Real Madrid.The match no easy at all,Liverpool keeper,''Karius'' F++k up big time!,i con dey wonder why Liverpool no use ''Simon Mignolet'',but sha as E don happen already E don happen be that Nobody fit change the facts.
Our Egyptian Winch,''Mohamed Salah'' don fracture hin shoulder via that tight Marking wey Sergio Ramos give am.
We,from ''Premier League In Pidgin'' dey Congratulate Real Madrid for their Victory and we dey also Congratulate Liverpool Sef because E no easy, I Dab for Mane,Lovren and Robertson performance,they impress us no be Small ,Walahi if no be Robertson,''OGA C'' for don Score Goal and if no be Lovren,''Bale'' for don Score Hat-trick for that Match.
As we take know say our Oga Boss for football Ototo C no too play well sha,Even Toni Kroos,i Swear i no go LIE for Una,Ever Since wey i watch Real Madrid Games this Season wey pass,i never see Kroos flop but i see as E flop for Final against Liverpool,people wey Steal the show for the Match na Marcelo,Modric,Benzema,Bale and Ramos.And people wey MUMU for the match na Karius,infact i no see Wijnaldum sef.Na for the match gan i con believe say Liverpool Miss Chamberlain Wella.
And Real Madrid own Con too much,this one wey dem carry na 3 times in a row,and the 13th times in history, E con make them the team wey carry am pass.
All the way,Congrats to them,and we dey also wish Our Egyptian Winch and Carvajal quick recovery because the kyn rumour wey we see online be say our Egyptian winch FIT Miss WORLD CUP but no be our Prayers sha but we go confam am later to see whether E go play world cup or not.
People wey score na Benzema and Bale and E come be Shameful thing Ronaldo no follow for the Score Sheet.Na Bale Score Two Goals and the two Goals dey Expensive.The 1st one na accrobatic and the other one na Outside 18 shot!! [ only those wey play PS2 go understand wetin i talk here].
And Benzema Score Hin Goal via the Mumu wey Karius Mumu. E just drop Am for Benzema and E deflect Benzema Leg before you know,BOOM!!! na GOAL!!!!,But before Bale Score Hin Two Goals,Mane bin Equalize Benzema Goal,That is to Say Na Benzema First Open Net.[ So the Match bin End 3-1]
Another People wey Steal the show for Champions league na ''DUA LIPA'' and ''SEAN PAUL''. Their Performance for the Opening Ceremony na die I swear down!!! Especially DUA LIPA,the girl dey Sexy, con dey Fresh ontop.Her voice too Sweet ehh,I con dey die for am but wetin Man go do as i no fit get am?.Omo the Girl Sabi o, No be Small,as i dey see am the GIRL na Better Pikin, E be like say She go Sabi the Thing o [if you know what i mean].
Congratulations @jameseduardo! You have completed some achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :
Award for the number of posts published
Click on any badge to view your Board of Honor.
For more information about SteemitBoard, click here
If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word
STOP
Do not miss the last announcement from @steemitboard!
Downvoting a post can decrease pending rewards and make it less visible. Common reasons:
Submit