Ona good morning inside diz morning for steemit,
Omo na my first pidgin page be dis so make I introduce ma self.
First of all na youngjohn get this diary and everything na personal parole. Youngjohn na shy guy oo, I shy wella but wetin concern me, I come world alone and I go die alone too.
Today
Omo today na for night class I spend my early hours, I go read my books because man must to pass exams, na me and my closest friend go read together.
Na so Tym reach to cut home back oo, I say make I withdraw last 500 naira for my account (tanks to gtb, dem dey always load their atm with 500 naira denomination. As I bounce reach atm I notice say I no carry my atm card from house.. .. . Ha ha ha.... E pain me ehn.. .. I just bone am dey go house.
As I reach house dem dey do morning devotion for my lodge, I just bone go sleep.
I hope say today go good for me in Jesus name.
Thanks, na so my morning take start ohh.