Na girl job!

in life •  7 years ago 

How una dey my people? How every nah?

Ise obinrin ni (na girl job).

I no know how e be for your side oh but for my side here for Naija, people get the mentality say certain jobs and house work na for girls.

image
[Source: my phone]

A family wey get 3 boys and 1 girl go expect say na the girl suppose dey cook and sweep for house unto say na girl job.

As girl don dey reach 5, 6, 7 years, im mama go begin carry am go market say make she sabi how to price things and buy better come house when she don grow. When im mama dey cook, she go dey inside kitchen dry carry salt and seasoning.

I been remember dah year for hostel, na me be the only girl for our lodge, make my people sweep na lie, dey go tell me say na girl job; make dem cook, na war, dey go still tell me say na girl job

How we go change this mentality for our society? No be only girl suppose know how to do house chores, we gather dey live for the house, dey chop the food.

image
Naija.ng

The one wey dey pain me pass na when boy and girl do the same thing and them papa and mama gather dey yab the girl like say na girl come dis world come suffer. Some families self still dey get course wey na only boy fit study; engineering, mathematics and medicine for boys, law and nursing for girls.

How we go change this na girl job nah? As a girl, wetin you dey do unto say na girl job?

Kudos to @jeaniepearl and @rebeccafl, una be girls wey dey do man job

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
Sort Order:  

Hahaha
My sister am humbled oo, sebi they talk say wetin man fit do woman fit do better.

But as per house job, even my junior brother for house go tell me say... Sebi daddy no dey do house work, say himself no wan do house work oo.
Abeg make we correct that mentality, guys dey help for house work...

Na so my sister

If to sey i fi speak pidgin wella i for write something wey dey longer.
This your post make sense and it dey focused on real life issue.
Thumbs up!

Thank you. Me sef just say make I try write in pidgin as pidgin no get rules.

Na una get d house nah winks nice 1 tho

Lol....you sef be member of na girl job gang bah?

No! But u sabi say we no fit dey Equal. I dey respect every gal tho, una be d real deal! Esp doz wey sabi tins do.

Truth be say na so our culture be and we no fit change am. E get job wey be for man and job wey be for woman but if you try get parents wey go school dey exposed those kain parents no dey do all this kind thing. The change begin with you. How you raise your pikin na so e go raise im own

Na so. Na tradition cause am true true.

Abegi, na girl work, don't come and start giving them liver, guys na the king, me Neva c where a king dey wash plate... Kolewerk

Mae God catch you, make Him gift you 5 daughters. We go see how e go be nah.

Hmmmm, you try my sister.
But I no gree say wetin man fit do woman go do better oooo
Lai Lai.
Nice post anyway

Siddon there, time go tell you how e go be.

Lmao
Girls are taking over

Na so...power to the girl child💪