My country people,i salute una,i cut cap for una,wetin make me i like steemit b sey,one day,i dey my house,na my bros dem come visit me @classic717and @mritsnobigdeal come dey yarn me about steemit and the cash wey dey,sey na better business o,As i come listen to dem finish,my country people,registration don start ooo but i come dey wonda weda this thing na for real,i kukuma join dem.my introductory post come fetch me money for dollars na i come shout sey,i don get dollars o,na dey thing come dey sweet me for belle.
One fine day,i come sitdon come dey reason sey this steemit beta pass government work o,sey if i sabi am earlier,i for no dey carry file dey waka for street dey fine work or go dey standa for post office dey write application letter wey be sey at the end,i no go get dey work.As dey come bring me up for steemit,i come see sey,i no dey lack change again for pocket,i fit chop three(3) square meal,i no dey depend for guys again.my steemit name na @andy212,i want use this medium thank @ogoowinner for this Pidgin contest,i pray sey make God almighty bless you wella for me.Ameeooooo.
Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!