I believe say every head geh d ogbonge right to be sighted,heard nd dey give dem original lovu
I bn get d believe say for this life everyone bn d same
I geh d believe say nah every person geh d scope fr one thing
Believe dey for me say me nd every person geh dt special part fr we life
I believe say nah every person get jesus and judas inside dem buh nah only jesus me i go dey give food
I bn geh d believe say all dem gods are just created to helep keep peace buh nah you and me comes first for this shikini world
I believe say nah do me i do you nah him b this life
I no go dey treat people fuck up fr d bad thing wey dem do me buh my aim go b to helep em develop
I no go engage in any black market business
I no go dey lawyer people buh understand them
I no go gree jealousy,bad belle control me life
Me self go do one isaac newton stuff wey no go gree people forget me after i dn pafuka
Even if dem b throw me in d middle of lion like daniel i go still remain strong like samson
I no go even gree fear for my dictionary
Any bad belle nd satanic thought for me mind shall not b given admission,nah only positive nd godly thought fit gain admission
I go dey original like dangote,photocopy no b my thing
I believe say dz my small brain fit do anything great
I believe say life nah express road and overtaking dey allowed,i no go ever pass my speed limit
I believe say peace nah d koko
I geh d believe say to dey helep other nah d way
I believe say to dey forgive nah way of life
I believe say love dey
I believe say mercy dey
I believe say nah everybody go geh justice
I believe in you and me
I dey swear say i no go escort dem come this life buh me self go make am
Me Salman Abdulrasheed go dey live by this me principle till i cease to exist.