MY GIRLFRIEND DONATE KIDNEY GIVE ME AND I NO LOVE AM AGAIN

in naijapidgin •  7 years ago  (edited)

My country people una good morning. How una dey? This cold reach una side because e be like say na everywhere for we country this rain fall Sha. Rainy season don land again, make una dey carry umbrella and extra shoe Waka o. Remember how we road be for naija.

IMG_20180412_095921.jpg

The matter wae jam us today na about babe wae donate kidney for man

I de play online nai I see wae this boy wae be footballer so all tru is time wae he de play ball he developed kidney problem and the guy just de manage as e see small small money for the ball wae e de play, so time come reach wae e be say him not fit manage again and the doctor wae de help am tell am say he go need another kidney or he go die.

So this boy mama don find people wae go donate them no see and him papa no gree make him sister donate... As him babe see am say him matter don de bad, the babe come say him go donate... Even the girl mama say make him no do am say she fit die but love Matter catch the girl and she no tell anybody come finally donate

So recently the babe go de cry Because the guy tell am say him no fit date am again say him no like the babe wae donate kidney again.. Even me sef shock say which kind heartless person b this one.... Because the guy say him no sure if na God plan for him life

I wan ask if he de possible as a guy say u go stop to de love girl wae dash you kidney and if you be girl watin you go do

Personally first me I no go even drop any kidney

Abeg I wan hear ur opinion for this matter

Na @mittymartz bring this matter jam us today

IMG_20180319_092844_398.jpg
Na @mittymartz design this avatar!

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
Sort Order:  

Make the guy return the kidney na.

Imagine! The guy sister no fit donate the kidney self.
If na me be the girl brother ehn..
Infact I don dey vex like this self...

No long mata for dis one. Na to collect the kidney back and guy go pay for the time he don rent am and inconvienences charges.

Ah this one na ogbonge matter oo. First of all the guy dey heartless second of all I'm go get reason for the action wey he wan take.

But as for me I'm dey mad gan because me i no fit do am, how babe go donate her kidney for me i go kan leave am. Na wicked person him be oo

I no understand this gist. You no love me mean say you no go love my kidney o because a part of me dey inside you. Oya make we go do surgery make I collect my kidney back the everybody go Waka im own. Gaskia.

You no well bi dat na

If i wan give my kidney, i go give to help the person no be because e be my boyfriend so that if casala burst tomorow, i no regret am.

The guy na werey o. So heartless!

I believe myself die
I no go try am at all not even for dream say i wan donate wetin give man
I pity the babe sha make she just take am say na God use her to save the guy
But the guy too no try o
If not for anything sef e for still reason the babe small

To be realistic , e dey possible but e take mature mind to always remember her sacrifice then know say ,no mata watin, him need stay. Sacrifice be for many ways, some na trust,some na virginity ,some na money, some dey agree make Dem dey with the guy even if their mama no agree, all this na sacrifice yet many people dey still betray their partner. So the matter be say, the guy don loose someone valuable for him life,make the girl move on but karma go meet the guy one day

Na wa,dis tory funny die,me gan like dis no fit donate my kidney give person oooo.but as to say maybe i finally do am,the guy come dey yarn tori wey be like fowl wey no wake up well for morning,na journey of no return i go send am go sharparly abi na craze qan worry am,which kind yeye talk be dat.

Love mata sha,, na so d thin make me craze go dash one girl like dat my school feez wen i been dey 200 level some years ago,.
Because say she claim say she get urgent problem come even promise 2pay half self since she know say na my school feez oo,, at d end after i give her d money i no ever see my babe again... Na God really save me say i letter fit gather money pay am just 3weeks to exam.
I hear from her friends slf say na ghana she even enter after i giv ha d money o.
Nways as for d guy wey dump d gal na only God dey judge all those kin people bcos i belive say dem go still jam big problem for future