SUNDAY MATTAZ WEEK #2

in naijapidgin •  7 years ago 

My country people I hail una o. Today na Sunday so make I first salute una happy Sunday I Sabi say today nah plenty rice and stew hope say we don chow plenty.
We don come again but today make we play our normal Sunday play wey we d play.
E dey simple and we go like am well well.

DSC_0132 (2).jpg
Nah photo snap this one

Wetin we go do today?

Snap wetin you wear dey go church today or you were go church. Drop am for the comment section and write wetin you learn from wetin dey teach for church today. If you no go church, I no know as you want do am but e better make you go church you hear?

DSC_0133 (2).jpg

After we go go whatsapps group then we people go choose the best five Sunday wear. Na Dem go win our gift for today.
Wetin you dey wait for? Oya alenle.

na @oliverwilliams na im bring this one come nak una today o.
IMG_20180215_155325_695.jpg
Nah @mmartymartz give us this fine avatar

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
Sort Order:  

IMG_20180311_115258_108.JPG

My people i greet una oooo,how una dey,hope say body dey kampe,my people i say happy sunday to una all.the thing wey i learn for church today be say make we no be church goers alone,make we do wetin they yarn us for church,say somepeople they fit sleep for church self,na all the service they go attend,sunday service o,bible study oo,they no go miss one,but their hand work wicked pass people wey never see the four corners of church self,so make we no be church goers alone,make we dey obey wetin they tell us to do and again i learn for church say God get better plans for us,say God want make we get money,get good husband and wife,but before this God plans for our life show,we must to serve God oo if we no serve God,his plan for our life go remain with am

Oshe hot babe

E be like say me and this person reason alike today o.
Me self decide say na suit I go wear today.
Today na cooperate day for church. And I hear say babes and big men dey come give us lectures.

No mind me jare. I learn plenty things for church. Today topic na Everlasting blessing..
I swear e con be like say make I no comot for church. I sha learn many ways to achieve the blessings.
image8.jpg

IMG-20171209-WA0021-1.jpg
Hello my better people, how una Sunday be my own make brain die. Wetin I learn for church na about success, I learn say the way to success get stages. U gas know who you be, for God correct book talk say we be confirmed generation, God pikin etc. If you know who you be then things go dey work for you. Like Oga Buhari, if you want see am na die but e son fit Waka go meet am as e like.
Then know who we serve, Bros Job talk say I know say my oga liveth. If you know who you dey serve this go Waka like moon walk for you. E go too sweet
Then wetin we get for hand na the last thing Bros Moses get staff and na that staff he take do wonders. We all get hand work na just to know wetin e be make we use am wella.

my pipu I greet una for the language wey una understand. How una dey? Hope say una dey kamkpe.
IMG_20180311_124623.jpg

my pipu happy Sunday
the thing wey my pastor wey e name Na Pst.Dr.Timothy Adeniyi preach today Na my change will come.
the text Na from Job 14:15.
wetin I learn be say

change Na the only thing wey no fit change.
Na only our baba Goddey fit change the thing wey be change.

and for us to enjoy change we must do some kind things wey I list down as you the read

  1. You need Jesus
  2. You go also vex with the condition wey u dey now
  3. You go also change the way you dey think
  4. you no go give up
  5. Finally finally you go the pray well well.
    my pipu for Naijapidgin Na here I pab break. IMG_20180311_095520.jpg

Nice

She na you get that car wae de your back 😂😂

Na me suppose get am but my friend Na e dey with d key

IMG_20180309_105130.jpg

I hail u ooo, my country people, na this simple dress I wia go meet papa God today ooo.
Our today topic na "identity what's written about you from the scripture"
Our pastor talk about plenty pipu wey discover dia destiny for inside bible,pipu like Jesus, John,joseph all discovered their destiny from the Bible.

I no go miss this one oo my people,
As today dey hot i need to drop this one here too
IMG_20171231_103732.jpg,
Since today na our malee [mumsi] dem day, the thing way happen for church no be small somthing,
Todays nai all the mumsi dem for anglican church celebrate MOTHERS DAY world wide and u suppose know na say when mumsi dem dai do things like this every were go just shake come hot join like hot paper soup with fresh fish😁.
Nways church service today come get levels die cos no dulling moment even near the place, n e come be like say baba God just from heaven ehh come down to come witness the kind things way this mumsy dem display today oo, n i sure say baba God take emm tym wella becos ee just dai like say we visit heaven small😁.
Their theme na : the Godly woman
Text na from :1peter chaptr 3 from vrs 1-end.
Dey really teach many things oo and some include.
Talk show
How mumsi dem suppose teach dia pikin dem God tins
How mumsi dem fit start smal buisnes to help dia family too, especially for dix kind naija way head burn plenty popsi dem,
And so many othr things too oo.
Well even some pikin dem come decided to display join oo soottee dey come dance jolly for the mumsi dem too
IMG_20180311_183836.JPG. IMG_20180311_183814.JPG
As the place dai hot dey go our maalee dem (mumsi) come decide to display small tin tooo finaly come end am with ogbonge prayer and blessing from the eldest mama wai dai onboard
IMG_20180311_114416.jpg.
As them finish service, na so the mumsi dem say make every body come go locate and migrate to the side were item 7 dey, were rice n stew very plenty dey hapen. Omo una need see the food sha but i no go upload am here so that some people throat no go fall oo.😁.
Nways my people my people na so my sunday service take go sha but incase u never chop sunday rice till now beter enter warri come locate me as e stil dey hot here,. una weldon.

IMG_20180218_125237-1.jpg

today church sweet well well, me come learn many many things as awa pasto carry beta beta tori come scatter ground, me come learn as im come tell us say for this lent wey we dey, if we want do fasting, make we no dey carry face like say we dey follow person fight, sey if we do am like that, baba GOD no go give us ansa for awa prayer, e come talk say make we dey rub oil for face if we dey do fasting, sey na wetin GOD want make we dey do be that.
IMG_20180218_125225.jpg

Loading...

I go just upvote as I no take picture today.

I hail o.....

You try

![Snapchat-2135115183.jpg](
Gbosa to all my naija peeps. As per today na Sunday things na so, I follow wetin naija pidgin dey do. I dey do set sound for church and dey show things on top the TV for church. Na why the headphone dey my neck.
Wetin I learn from church na WWW. Work for God, Work with God and Walk with God.
If you work for God, God go dey Work for you after to do that one, you kan do things with am. He go kan be your business partner after that one you go kan turn padi with Baba God.

Dragon dis pic funny I swear

Baba ur church make sense oh. Lol 😁

I upvoted you hopefully you will do your part...welcome to this beautiful family follow upvote and resteem... steem rocks.