SEE WETIN BIBLE TALK...

in surpassinggoogle •  6 years ago 

People Wey Don Die Fit Come Life Again?

You go sey...

  • yes?
  • no?
  • dem fit?
    HOW WETIN BIBLE TALK FIT HELP YOU
  • Your mind go rest sey you go see your People wey don die. 2Corinthians 1:3,4
  • You no go fear to die. Hebrew 2:15
  • You and your people wey don die go fit still leave together again. John 5:28,29

WE FIT BELIEVE SEY WETIN BIBLE TALK NA TRUE

Yes, make we see three reason wey go make us believe:

  • Nah God give us Life. Bible talk sey nah Jehovah God 'dey give life' As e be sey na God give us life, na im be sey e go fit give life to person wey don die.

  • God don bring people wey don die come life before. Bible tell us about eight people wey don die and God bring dem come life again. Among this people, man and woman dey, old and young person dey. E even get one wey don die for four days. (John 11:39-44)

  • God really wan do ham again. Jehovah no like as people dey die at all, e teally wan comot this enemy and give people wey don die life again. Jehovah want bring everybody wey im get for mind come back to life make dem fit enjoy better life for the paradise wey e don promise for this world. (Job 14:14,15)

MAKE YOU THINK ABOUT THIS QUESTION

why we dey grow old and why we dey die?
Bible answer this question for Genesis 3:17-19 and Romans 5:12

Jehovah is Lord

Follow Jehovah Witness People Learn Bible.

Visit our internet www.jw.org/pcm

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
Sort Order:  

@Franklinolas, thank you for using the naijapidgin tag.

We encourage and support minnows.

Join us on discord: https://discord.gg/5SR8CH4 for more fun and to submit your posts for curation.

You like what we are doing and would like to support us? Join our trail here: https://steemauto.com/dash.php?i=15&id=1&user=naijapidgin


Sponsored by @ogoowinner