OUR PRESIDENT SAY HE GET UNFINISHED BUSINESS

in naijapidgin •  7 years ago 

My country people, una goodmorning o. Today na another Thursday. How the weather be for una area because the Kain heat wey dey sama me for where I dey eh, I neva go hell fire before o but if this one na small idea of how e be, I no sure say I want go there.
IMG_20180503_100747_003.jpg
Unto the matter wey concern us. This week many many things happen for we country and we don try to bring am come una domot this week. If you no dey follow us before, make you check we blog dey updated.

Today, we go talk about our ogbonge president, president Muhammadu Buhari. Wetin he do again abi? Yesterday, Voice of America interview am and he talk many many things.

Buhari talk say before wey he be military general he dey give orders but now as civilian governor he dey receive order from people. Although he no talk who he dey receive order from but make una look am well, he dey run dis country like civilian president abi as military president?

As Dem dey ask am dey go, he still talk say wetin make am want come back for second term na because he get unfinished business especially for the area of security. Our president talk say Boko Haram still dey use small small girls dey force Dem dey carry bomb go dey blow churches, mosques, parks and even markets. He talk say Dem still dey sambisa forest but the Nigerian army dey prevent them to come out.

Abeg my people, this Boko Haram, who dey sponsor them dey give them their better better weapon and how e take dey reach them?

Una believe say Buhari dey try him best to solve this problem and again he no fit do am now na second term he go take do am?

Na @zizymena carry this one come meet una this morning. If you never join us for WhatsApp, you dey miss o, oya touch here

IMG_20180319_092844_398.jpg

Na @mittymartz design this avatar for us.

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE STEEM!
Sort Order:  

The man dey receive order from him cabal or cafa because we sure say em no dey listen to any of us

We no wan know the unfinished business... We don tire for am! Abeg we no want make him finish the unfinished business! Make im carry in wahala go!

Una leave baba go slow for me oo.😁,
I like our presido joor, 2019 come aw still vote baba jaree to mak all of us dey suffer dey go

Which kain unfinished business. Abeg make him comot go sidon somewhere. Make e go do the unfinished business for in house. We no want am again. E don old for ruling us

Abeg make him no worry abeg. We go manage the business. Make him go rest.
Abeg i hail una o @naijapidgin

  ·  7 years ago (edited)

I no dey like this kind talk... To me no person deserve second tenure because na that time dem dey do the undo... Me no be political person but make baba tell us the unfinished business first... Then we go reason am, con know weda we go put am back or not. Even though say we know say na e fit win am again unto say kano don get 5million registered voters. Even pikin of 5years don register 😂😂😂

From the office of the secretary of the lazy Nigerian Youth - Prayzz

Which kind unfinished business? Abeg e just commot, e don try already.. E no do anything forr security within 4 years, na now e wan do am?.

No be only unfinish business..
Abey for me na the people way dey for top government like him, dey sponsor those Boko harm oo..
Make him just rest, we go help am do the unfinish business by our sef oo..
Una good afternoon ✌️.

Una goodafternoon o..
Na this buhari case na e we discuss for cds today, sote my mouth kon tire to yarn. I don tire for this man case. How can only one person Bring untold hardship on millions of people

No be small Buru ha ha! Naija youths no be Layzi, dem de work hard to make am even on Steemit. Hahaha

this man no wan comot from aso rock abi? abeg make this man do comot make another enter, presidential seat no be person papa property abeg o

This man dey funny oo I no even know what to say